Tejaswini Niranjana

From Wikipedia

Tejaswini Niranjana (dey bon am July 26, 1958) na Indian professor. E dey stock difren kolsho, dey translet an e dey rait buk. Pioul sabi Niranjana wel wel bikos e don add nolej to kolsho stodis, gender stodis, translashon, an ethnomusicology ( na di one of Indian muzik e rait pass). E papa nem na Kulakunda Shiva Rao but pipul sabi am as Niranjana an e mama nem na Anupama Niranjana. Niranjana papa na dey rait film an also buks an e mama sef dey rait buk. Niranjana hosband na Ashish Rajadhyaksha wey bi raita an pesin wey dey stodi kolsho of pipul.

In 2021, dey give Tejaswini Niranjana one awod wey bi American Literacy Translators Association Prize for prose fiction Translashon. Na one buk kol No Presents Please a Jayant Kaikini rait. Di buk na smol smol tori wey tok abaut abaut Mumbai siti. Di buk No Present Please till kolet di DSC Prize for South Asian Literature 2018 in 2019. Dey tok sey na Niranjana an Jayant Kaikini get di awod togeda.

Na Niranjana stil get di 2018 Humanities and Social Sciences Prestigious Fellowship, Research Grants Council, Hong Kong. Na e stil kolet di Karnataka Sahitya Aka demi Award for Best Translashon of 1994. Wetin dey tek no Niranjana pass na wetin e rait abaut how govamet of oda kontri go wan dey kontro anoda kontri an translashon, e raitin abaut wetin wuman dey sofa an di "kweshon kolsho" in India. Pipul stil no am for e risach on muzik ( patikula muzik wey kom from Karibian, Hindustani klasika muzik, an Indian-China kolabo).

Niranjana get Masta digre in Inglish an "Aesthetics" from di Yunivasiti of Bombay. E get a MPhil in Linguistics from di Yunivasiti of Pune, an a Ph.D from di Yunivasiti of Kalifornia, Los Angeles.

Niranjana dey among di pipul wey fom an e stil bi sinior fello at di Center for Study of Culture and Society, Bangalore.