Talking animal

From Wikipedia

hanima wey dey tok na eni-hanima wey no bi pesin wey fit tok or do bodi like sey e bi pesin. Meni hanima get habiliti to pass mesej as if dey bi pesin. We no fit tok sey dem dey spik human bein langwej bikos wetin di hanima dey tok no get some karata wey human langwej dey get. For ezamouk, dey word no get koret grama.

Meni pipo wey dey do risach don do dia best to fit mek hanima fit yuz part of dia bodi pass mesej like sahin langwej. Weda dis one fit enta katigori of langwej we stil neva no for now.

Shans sey hanima fit tok human bein langwej[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dis one mins hanima wey fit kopi how human bein dey tok ( di hanima fit no onda wetin e dey tok). One ezampul of hanima wey fit do dis kind tin na Parrot. Some parrot de wey fit some human word an stil folo human bein di-skuss smol. E get one parrot wey e nem na Alex wey fit do dis tin. Di parrot fit ansa kweshon abaut kolor, nomba, shape of tins an stil ansa yes or no kweshon on dem. Rekod de sey di parrot even sef ask kweshon abaut di tin. Anoda parrot wey e nem na N'kisi, fit yuz 950 word to form sentensis an ondastand some grama .