Jump to content

Suuny Okosun

From Wikipedia
Suuny Okosun
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemSonny Chenj-am
Wen dem bon am1 January 1947 Chenj-am
Wen e kpai24 May 2008 Chenj-am
Place of deathHoward University Hospital Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathcolorectal cancer Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Stai of song abi fimhighlife, reggae, gospel music Chenj-am

Sunny Okosun (dem bon am on 1 January 1947 rish 24 May 2008) na Naija musikshan, wey plenti sabi as Ozzidi band oga kpatakpata. E kol im band wey bi nem of one Riva for Ijaw, Okosun tok sey wetin im band Ozzidi Stan for na mesej dey. Sumtims dem dey rait im nem lik dis; Okosuns an im fest nem Sunny. Na one of Naija Ogbonge musik pesin in 1970's rish midu 1980's. Okosun's stai na Afrika pop musik, Ozzidi, sabi sing wit Afro-beat, reggae an funk muzik. Fom 1977, dem sabi am as e dey uze im song dey tok abaut hau dem no dey du Afrika pipu wel, politis an som oda tins.

How e tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen e dey smol, na for im granmama plez e sta for Ibore, wey klose to Irrua, for Edo Stet. E go Enugu to sta wit im papa an mama, im papa wok wit Nigeria Railway Corporation. Okosun go difren skul to len, e stat wit St Brigid's Skul, Asata, Enugu bifor e go govmet trade centa in Enugu. E no finish fom wia e dey len bifor e komot. Bikos e lik to akt fim, e go Legos to go akt fim. Wen e dey Legos e go drama lesson for Surulere, e no finish di lesson bifor e go Enugu bak, Okosun ci chenj to du smol pat for fim, wia e tek get chenkj to wok wit Enugu Ogbonge drama ticha, profesor John Okwerri. How e tek uze bodi an maind wok wel for di grup mek am du som Televishon an redio skits wit Eastern Nigeria Television Station.

How e tek kpai

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Okosun kpai wen e dey 61 years old. Na Colon cancer bi wetin kil am on 24 May 2008 for Howard University Hospital, Washington DC. Dem beri am for im hauz wey dey Yaya Abatan Street, Igba, Legos, Nigeria.

Som of im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Ozzidi (1976)[1]
  • Ozzidi For Sale (1976)[2]
  • Living Music (NCC, 1977)
  • Papa's Land (NCC, 1977)[3]
  • Fire in Soweto (OTI, 1978)[4]
  • Holy Wars (NEMI, 1978)
  • 3rd World (NEMI, 1981)
  • Mother And Child (OTI, 1982)[5]
  • Which Way Nigeria? (Jive Afrika, 1983)
  • Liberation (Shanachie, 1984)
  • Revolution II (HMV, 1985)
  • Africa Now Or Never (HMV, 1986)[5]
  • Ozzidi/Ozone (1989)
  • African Soldier (Profile, 1991)

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "Ozzidi Song… Eight years after Sonny Okosuns' exit". The Guardian Nigeria News – Nigeria and World News (in Amẹ́ríka Ínglish). 5 June 2016. Retrieved 12 July 2021.
  2. "Sonny Okosun: a Pan-African Reggae Maestro". African And Black History (in Amẹ́ríka Ínglish). 8 April 2020. Archived from the original on 12 July 2021. Retrieved 12 July 2021.
  3. "Remembering our musical icons: What would have become of them today!". Vanguard News (in Amẹ́ríka Ínglish). 17 January 2013. Retrieved 12 July 2021.
  4. "Fire in Soweto!". Vanguard News (in Amẹ́ríka Ínglish). 15 June 2010. Retrieved 12 July 2021.
  5. 5.0 5.1 "Okosuns, Sonny Encyclopedia.com". www.encyclopedia.com. Retrieved 12 July 2021.