Susanne Rosenberg

From Wikipedia

Sussane Rosenberg (dey bon am August 29, 1957) na Sweden wuman wey sabi sing tradishonal song. E na professor an risasha. Sussane Rosenberg gro up outside Stockholm an e dey sing eni wia wey e see chans to sing sins heli 1980s. Na for Royal Kolej of Muzik, Stockholm e to stodi for one paformas program in 1984 go rish 1988. For di skul, Rosenberg don dey tish tradishonal muzik an e na professor sins 2006. Bitwin 2004 go rish 2008, Na Rosenberg bi di head of Dipatmet of Folk Muzik.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rosenberg rid Musicology in Stockholm Yunivasiti from 1982 to 1984. E stodis na abaut how one patikula tradishonal singa dey yuz sing. E wok as tisha for Sibelius Akademi in Helsinki from 1987 to 1991. Rosenberg tok abaut e risach wey e wan tek kolet e Ph.D satifiket wit di komitee wey dey give satifiket in Royal Kolej of Muzik in Stockholm an di Sibelius Akademi wit e pepa: "Kurbits-ReBoot: Swedish Folk singing in a new artistic context".

Muzik karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rosenberg na one of di popular tradishonal muzishan wey kom from Sweden . E sabi yuz gud vois teknik dey sing baroque, jazz an nowadaz muzik. E stil dey wok as risasha, tisha, komposa, an raita.

Rosenberg de among di pipul wey no let tradishonal muzik song-dem no kpai as e dey risach dem an dey yuz am sing for e song. For 1990s, Rosenberg divelop meni sound in tradishonal singin in di group wey e fom "Folk Women's Choir" (1993-1996). E don rait song for some muzik group like "Pust'" (2000), "Stjärnan" (2013), "Miss a Vox Mundi" (2021) In Sweden, Rosenberg don join bodi wit di komposa Karin Rehnqvist an du meni wey Rosenberg do like: "Puksänger-Lockrop" (1989), "Hrtluft" (1993), "Rädda mig ur dyn" (1997), "Sä gär en dag" (2000). Rosenberg don also join bodi wit some daretor like Peter Oskarsson ( Den Agora Vreden, 1988-1990) an Leif Stinnerborn ("Ljuset" 1996).