Jump to content

Sunday oliseh

From Wikipedia

Sunday Ogochukwu Oliseh (dey bon am 14 September1974) na Naija forma futbol playa an forma Naija futbol tim manija. Wen Oliseh stil dey play futbol, e na difenda. Oliseh tall wel wel an e don play for plenti futbol tim like: Ajax, Borussia Dortmund an Juventus. Meni pipo dey si am as one of di best defenda wey Afrika don eva produs.

How e tek play futbol

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oliseh dorin e time play 63 futbol game for Naija an na onli three time e score for Naija. Naija chuz Oliseh for dia tim wey play FIFA Wold Kup in 1994 an 1998. Oliseh stil join di tim wey play 1996 Olympic Kompetishon wey Naija tek win Gold medal.

Oliseh kari nomba three posishon for di best futbola awod wey CAF do in 1998. Pipo dey rimemba Oliseh for di goal wey e put for Spain net wen Naija futbol tim tek win Spain 3-2 in France 1998 Wold Kup Kompetishon.

Oliseh no folo join di tim wey go 2002 Wold Kup Kompetishon even sey na im kapten di tim wey go 2002 Afrika Kup of Neshon for dat year. Oliseh retiya komot from Naija futbol tim in 2002 bikos e tok sey Naija govamet no gree give dem their halawas moni. Borussia Dortmund tek Oliseh mek e dey go bikos of di fight wey hapun bitwin Oliseh an Vahid Hashemian wen Vfl Bochum boro am to play for dem from Borussia Dortmund.

Wen Oliseh don rish 31 year Old, e tok sey e don ritaya patapata from plerin futbol. Di last tim wey Oliseh play for na K.R.C Genk wey de Belgium

How e tek stat to bi tim Manija

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Belgium Oliseh tek stat to dey do manija for futbol tim. Di fest tim wey e do manija for na di Onda 19 tim of 3rd Divishon Verviers. Leta Oliseh kom stat to dey maneji di sinior tim of Verviers in di 2008-2009 sisin. In 2014-2015 sisin, RCS VISE wey de Belgium 3rd Divishon chuz Oliseh as dia Klub Manija. In 2015-2016, Naija Futbol Fedirashon (NFF) chuz Oliseh as dia sinior tim manija .

Oliseh kwulify Naija tim to CHAN kompetishon, e kwulify Naija tim to 2018 grup faze of 2018 Wold Kup kwulifaya

Oliseh risahin as manija of Naija sinior tim on 26 February 2016. For June 2022, SV 19 Straelen chuz Oliseh to bi dia tim Manija an by August 2022, Oliseh don komot as dia tim Manija.

E pasonal Mata

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oliseh yonga broda-dem Azubuike an Egutu bi profeshona futbola too. E stil get anoda broda wey e nem na Churchill Oliseh an a nephew Sekou Oliseh

Klub wey e don play for

[chenj-am | chenj-am for orijin]
10501|
Klub Sisin Ligi
DivisionAppsGoals
Liège 1990–91 Belgian First Division 30
1991–92 161
1992–93 302
1993–94 260
Total 753
Reggiana 1994–95 Serie A 291
FC Köln 1995–96 Bundesliga 240
1996–97 304
Total 544
Ajax 1997–98 Eredivisie 295
1998–99 253
Total 548
Juventus 1999–2000 Serie A 80
Borussia Dortmund 2000–01 Bundesliga 220
2001–02 181
2002–03 20
2004–05 110
Total 531
Bochum (loan) 2002–03 Bundesliga 110
2003–04 321
Total 753
Genk 2005–06 Belgian First Division 160
Career total 32118

How e tek play for e kontrie

[chenj-am | chenj-am for orijin]
mash wey e play an goals by nashonal tim an year-
Nashonal tim!YearAppsGoals
Nigeria 199310
1994110
199530
199610
199740
199872
199930
2000100
200170
200270
Total542

Awod an kup-dem wey e don kolet

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Ajax
  • Eredivisie: 1997–98
  • KNVB Cup: 1997–98, 1998–99
  • Juventus
  • UEFA Intertoto Cup: 1999
  • Borussia Dortmund
  • Bundesliga: 2001–02
  • UEFA Cup runner-up: 2001–02
  • Nigeria U23
  • Olympic Gold Medal: 1996
  • Nigeria
  • African Cup of Nations: 1994
  • Afro-Asian Cup of Nations: 1995