Sunday Omobolanle
Hau e go bi
Sunday Omobolanle MON (dem bon am 1 October 1954) wey pipo Sabi wel wel as Papi Luwe na Naija komedian, aktor, play-raita, daretor an produsa.
How Im life an karia tek stat
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon am for Octorber 1, 1954 for llora, wey bi one town for Oyo Stet southwest inside Naija. Na im bi di papa of Sunkanmi Omobolanle. Sunkanmi Omobolanle na Naija aktor an fim daretor. Sunday Omobolanle don rait, daret, produs an e don show fase for plenti Naija fim dem. One of di fim-dem na: Adun Ewuro wey bi one naija 2011 fim wey Adebayo Salami show fase for inside. Dem sabi pesin for wetin im don do for Naija fim indosri, the foma Naija presido wey bi Olusegun Obasanjo awod am wit Nashonal awod wey bi MON.
Som of Im fim dem
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Adun Ewuro (2011)
- Konkobilo
- Oba Alatise