Storytelling

From Wikipedia
The Boyhood of Raleigh by Sir John Everett Millais, oil on canvas, 1870.
one pesin wen don don travu wel wel for sea Sir Walter Raleigh dey to di tori to e brodas

To dey tok tori na poblik an kolshora tins wey pipo dey do. Sometime, pesin wey dey tok di tori fit kwik kwik join e own tin inside di tori wey e dey tok. Evri kolsho get dia tori wey dem dey tok for entatemet, to tish, to mek pipo no dia histri, an to mek dia pipo bi pesin for sosaeti. Na three tins tori dey always get: how di tori tek hapun, pipo wey tins hapun to inside di tori, an how di pesin wey dey tok di tori tek see am. To dey tok tori fit mins mek pesin dey yuz mouth tok am an oda times, e fit mins difren metod of tellin a tori.

How to dey tok tori tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

To dey to tok tori stat wen pipo stat to dey imagine tins. Bifor pipo stat to rait na im to dey tok tori don de. Na mouth, hand, an bodi pipo fest stat to tok tori. Pipo wey dey dig graund to find informeshon bilif sey, na bikos of tori with rilijion mata mek pipo dey draw for stone long time ago. Pipo wey fest kom Australian long time ago dey draw somtin for big rock so dat pesin wey wan tok di tori go fit rimemba am wel wel. Di pesin go kom yuz mouth, muzik, di piksho for wall, an dans tek tok di tori. Dis one dey mek pipo ondastand meni tins abaut human bein. Pipo don draw for livin tree, sand an lif to rekod an tori yuzin piksho or raitin.

Tatoo wey de pipo bodi na stil pat of tori-tellin bikos e dey tel us abaut di famili wey dat pesin kom from. Tatoo stil fit tel us di tori abaut wia di pesin kom from an weyda e get moni abi e no get.