Stone Soup

From Wikipedia
Stone Soup
folk tale
Main subjectboiling chip, sharing Chenj-am
Aarne–Thompson–Uther Tale Type Index1548 Chenj-am

Stone Soup na European tori abaut tradishon wey pipu wey neva chop go convins pesin wey get to giv am smol to fit mek fud. For difren tradishon dem kol am difren nem lik axe soup, button soup, nail soup, an wood soup.

Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som pipu wey dey travu go one vilej, dem no get pot or wetin dem go cook. Wen dey rish dia, di vilej pipu no lik to dey giv niu pipu wey dem no sabi dia fud. Di travulars kon go river go kari worta insaid di pot, kon stil put stone insaid di pot, kon put am for fire. One of di vilej pipu dey wonda wetin dem dey du, kon ask dem wetin dem dey du. Di travulars kon tok sey dem dey mek "stone soup", wey dey sweet an dem go lik mek di vilej pipu sef eat am, an sey som tins stil dey mis insaid di fud.

Di vilej pipu wey wan trai di fud no kon boda to giv dem som carrots, dem kon add am join di fud. Anoda travulars in wey dey pas ask abaut di fud fom di travulars, an di travulars tel am dem tin, sey som tins dey mis from dia fud to mek am sweet wel wel. Plenti vilej pipu kon dey pas dey ask abaut dia fud, an dem dey add tins lik; lik potatoes, onions, cabbages, peas, celery, tomatoes, sweetcorn, meat (lik chicken, pig meat and beef), milk, butter, salt an pepper. Later later, dem kon komot di stone wey dey for di pot, wey kon mek vilej pipu an travulars njoi beta fud.

Di travulars mek di vilej pipu hep dem wit sense, Wen dey tel dem to kom eat insaid dia fud. Dey kon chenj am to beta fud wey pipu wey giv dem sumtin to put njoi.

Difren tins[chenj-am | chenj-am for orijin]

. Eastern European Syd of di Tori (wey bi Di dem tin as Western European tori) dey kol am "axe soup".

.Insaid di French, Hungarian an Russian Syd of di tori, Di travulars na soljas wey dey go hauz.

.Insaid di Hungarian tori, one solja wey neva chop ask fud fom vilej pipu. E ci one old wuman wey e convis to giv am sumtin e go uze cook soup, an for di end dai two share di soup, e kon sel di rock giv Di wuman.

.Insaid Russian tradishon, one solja du "axe kasha" (Каша из топора). Di tori end wit di solja wey Kari di axe wit am, bikos e wan chop am for road.


.Johann Peter Hebel, rait one buk for German, "Der schlaue Pilgrim" ("The Cunning Pilgrim", 1811), wia pesin wey dey go Jerusalem convis pesin wey e ci to giv am sumtin to mek soup wit im stone, e no kon leta eat di stone.

.In Northern Europea Poland an som oda kontris dem sabi di tori as "nail soup", an di tori na abaut pesin wey no get fud an wia e won stay, wey convis one old wuman to giv am wetin go hep am mek nail soup for dia two to chop.

.Insaid Portugal tradishon, di travular na pesin wey dey onli am, an di tori hapun for Almeirim, Portugal. Til todey sopa de pedra na fud of Almeirim.

Kolsho an histri pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid di Aarne-Thompson-Uther tori abaut kolsho e dey type 1548


Art, entertainment, Media[chenj-am | chenj-am for orijin]

Stone soup lik kolaborashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti tori dey wey tok abaut '"Stone soup" wen dey join hol di tori togeda. Ezampu na:

.Dungeon Crawl Stone Soup, na computer game wey dem no rimemba, wey uze difren codes of pipu.

.Stone Soup, smol pikin buk wey dem California Children's Arts Foundation du sins 1973.

.Stone Supercomputer, computer wey dem du wey get plenti smol smol tins.

.Stone Soup, na opun software wey dey hep pipu wey won du risarch.