Stella Brewer Brookes

From Wikipedia

Stella Brewer Brookes (dem bon am for January 22, 1903 an e kpai in November 1993) na profeso of Inglish for Clark Kolej (di nem leta chenj to Clark Atlanta Yunivasiti) from 1924 to 1969. Brewer na pesin wey de stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way an na raita.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Fannin, Texas dem bon Brewer on January 22, 1903. Brewer a one of di six pikin-dem wey J.H Brewer an Minnie Brewer bon. E papa de sel fud stuff an e mama na skul tisha. Brewer broda J.Mason Brewer too na tradishonal tori raita. Brewer get e Yunivasiti digri in Wiley Kolej wey dey Marshall, Texas. E get e Masta of Arts in Inglish from di Yunivasiti of Michigan an kolet e Ph.D from Cornell Yunivasiti in 1946 afta e hosband kpai. Di Pepa wey e tek kolet e Ph.D na "Folklore in the Writings of Joel Chandler Haris".

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Brewer bikom professor at Clark Kolej in Atlanta. For Clark Kolej, e bi hed of Inglish Dipatmet, advaisa to studet poblikashon "The Mentor" an e fom di |Atlanta Yunivasiti Sentra Literary Symposium.Brewer stil tish durin holiday piriod at di Alabama Stet Tisha Kolej. Na Brewer rait di buk "Joel Chandler Harris, Folklore" (1950), an oda wok wey Haris du. Brewer ritaya for Clark Kolej afta e don wok for 45 years. Dey give am Honorari Doktor of Leta digri from di Kolej. Brookes an e hosband dey aktive in di NAACP in Atlanta. Na Brewer give NAACP tok in Emancipation Day adress in 1939. Brewer put bodi for di George Federation of Colored Women's Club. In 1948, dey pik am to bi di "Bronze Woman of the Year in Education in Atlanta by lota Phi Lambda sorority. Brewer stil kolet odas honors from di International Mark Twain Society an lokal television stashon WSB

E pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Stella Brewer mari Enos Luther Brookes in 1928. Enos Luther Brookes na professor of Kemistri an fisis wey kom from Jamaica.