Sophia Morrison

From Wikipedia

Sophia Morrison (24 May 1859-14January 1917)na pesin wey dey fait for Manx Kolsho, dey rait an dey kolet Tradishonal biliv Stori an Kostom dem. Bikos of hau do tins dem wey shi don do tek mek pipul laik Kolsho, me I pipul dey see am as pesin wey get maut wel-wel among pipul wey mek Manx Kolsho get levul. Pipul dey rimenba am bikos of di majik stori dem wey shi don rait for Manx, an wey shi poblish for 1911.Wwtin mek pipul know am wel-wel pas na bikos shi dey fait for Manx Kolsho an wit di wok dem wey shi do wit di Manx Langwej Sosaiti an di Journal wey shi kol Mannin, wey shi stat to dey koret from 1913 tili wen shi kpai.

Hau Shi Liv E Laif wen shi stil bi Smol-pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Sophia Morrison for Reel Isle of Mau,as di nomba three pikin among di 9 pikin wey Charles Morrison(1824-80) an e wife Louisa(e papa nem na Crelin)(1830-1901) bon. E papa na biznezman wey pipul respet wel-wel.E papa get plenti boat wey dem tek dey kol fish an na e biud AtholStreet for Peel. Wen dem kaunt pipul for 1881,dem tok sey na Sophia Morrison dey stay for nomba 7 Athol street,bot e bi like stay shi even dey stay wit anoda famili for nomba 15 for dat Athol street. Na Clothworker skul for Peel naim Marrison go an shi stodi Muzik wit som of E famili dem frend Edmund Goodwin. Na Morrison bidi first pesin wey pas exam for Muzik for di Kolej for Trinity Kolej of Muzik an bikos of dis,dem giv am Awod. Apat of wetin pipul know abaut am wen shi dey for Kolej araund 11 yia old , most of e Laif naim dem no know abaut. Morrison stay for Ballig,nia On han so dat shi go dey fro dia go skul. Shi stat to dey put mind for langwej na so shi dey Sabi Manx an French,Irish,Scottish, Gaelic, Italian an Spanish. Sophia travul go Meni-meni ples like France, Brittany,Italian and Spanish.

Hau Shi do E Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sophia Morrison put di whole of e Laif to dey keep Manx Kolsho for evei wia. Wetin mek am put mind wel-wel for Manx Kolsho na bikos sey shi biliv say smol-smol pipul fit foget abaut Manx Kolsho. Shi rekod plenti tins abaut Manx Olsho an shi dey ekorej Meni pipul to dey sopot Manx Kolsho, to dey rait abaut di Kolsho. Shi try wel-wel ontop Tradishonal biliv,stori an Kostom dem plus Muzik, shi even mek pipul bogin to dey like enitin abaut Manx.