Social norms

From Wikipedia

Sosha norms na di norma or standad way pesin sopos dey do wen e de araund pipo. Sosha norms fit also bi di norma evri-day karata wey pesin dey bihaf wen e de for wie pipo de abi di standad karata wey pipo wan mek pesin bihaf wen e dey araund pipo. Di standad karata fit don bikom "rules or laws.

"Sosha norms" get pawa wel wel so tey e fit chenj pipo karata an fit mek niu niu law kom. Meni hoganizashon get meni meni bi-aviho. "Sosha norms" dey difren from idiya, or pesin karata wey pesin fit jos get by imsef.

Wetin "sosha norms" rili min sef[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti minin of "Sosha norms" na e de but plenti pipo wey go skul don pik onli dis four.

  1. wetin memba of a grup don gree to dey do
  2. wetin konsain bi-aviho an disison mekin
  3. di way some pipo don chuz to live dia life for a patikula sosaheti

Jack P. Gibbs in 1965 tok abaut three tins wey sosha norm must to get bifor we fit tok sey na sosha norm:

  1. wetin pipo gree sey one bi-aviho sopos bi
  2. wetin pipo espet sey one bi-aviho go bi
  3. how pipo dey see di bi-aviho itsef.

Wen Ronald Jepperson, Peter Katzenstein, an Alexander Wendt wan tok abaut sosha norms, dey tok sey sosha norms na wetin pipo espet mek oda pipo dey bihef for one patikula kondishon.

Wayne Sandholtz no gree for wetin dos three pipo tok, e tok sey wetin pipo espet mek pipo do no bi e bi sosha norms. E tok sey dat espetashon na wetin sosha norm dey korse no bi e bi sosha norms.