Snake wine

From Wikipedia

Snake wine na one ogogoro drink wey dem produs from karin snake inside ogogoro kontena. Di fest ples wey pipo fest drink "Snake wine'" na China dorin Westa Zhou empaya (c. 1040-770 BC). Akordin to China tradishonal medisin, wen pesin drink "Snake wine ", di drink dey give pesin pawa again.

Pesin fit get "Snake wine" drink in China, Hong Kong, Taiwan, North Korea, India, Vietnam, Japan, Laos, Thailand, Cambodia, an araund South-east Asia.

Wen dem get di snake, no bi di mit of di snake dem want but na di poisin wey e get.

Wen di snake don enta ogogoro, di ogogoro go helep relis di poisin of di snake inside di ogogoro. Afta dis one, "Snake wine " is redi to drink. Dis drink dey OK to drink. ( sometime sha, e fit no dey OK). Pipo sabi Hauxi street night maket wel wel bikos of dia snake fud an wine prodot.

Histri of di snake[chenj-am | chenj-am for orijin]

E don tey wey pipo wey like China tradishonal medisin don bilif sey to dey chop snake an all di tin wey de inside di snake. Na China dey fest drink "Snake wine" dorin di Westa Zhou empaya (771 BC) . Na for 300 B.C an 200 A.D we fest see medisinal rekod of "Snake wine'' in one buk kol Shen nong ben cao jing".

"Li Shizhen Bencao Gangmu" buk kom tok more abaut how dem fit yuz snake faze, snake bodi, for medisin. Di buk still tok abaut how pesin fit prepare am. One tin wey de inside snake wey e nem na snake bile na im dey give Yang Jisheng mek e yuz wen e get injuri in prison circa in 1554.

Di drink in difren kolsho[chenj-am | chenj-am for orijin]

In Vietnam, di komon nem na "Snake wine'' na rurøu thuõc. Anoda nem wey dem dey kol am but wey no too popula na rurøu rán. Odas drink no yuz snake but yuz lizard or sea horses.

Bikos di ogogoro wey de inside "Snake wine" plenti, na smol smol kup you go yuz tek drink am.