Skipping-rope rhyme

From Wikipedia
Skipping-rope rhyme
song type
Subclass ofchant, children's song Chenj-am
Facet ofskipping rope Chenj-am

Skipping Rope Rhymes (som dey lol am skipping- rope rhymes abi jump rope rhymes), na song wey smol smol pikin dey sing wen dem dey kari rope pas dia head. Di main song fit dey for wia dem saf am for eni kain kolsho wen dem dey du di pley. Ezampu of inglish lanwej own dem ci for 17th century. Like most tradishona tori, di skipping pley dey for difren way. Di artiku tok abaut word wey smol smol pikin wey tok inglish uze.

Histri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipu wey dey waka for difren kontri, ci as pipu dey uze rope pas dia head wit vines insaid 16th century. European boiz stat to dey uze rope pas dia head in di earli 17th Century. Dem tink dat taim dey di pley no gud for girls bikos e fit sho dia ankle. Dem no dey tok abi sing enitin. Tins chenj for earli 18th Century as girls stat to dey jomp rope. Dem dey tok, dey get rope, kontrol di game, an dey select pipu wey wan pley.

Insaid United States, girls plenti for di game wen dia famili muve go citis in di late 19th Century. For dia, dem ci beta ples wey smooth wey dem fit dey du di game, wit some oda pipu wey sabi di game. Anoda pipi tok sey, bak in 1833, as dem bring pantallets girls fit dey pley di game mek dia ankle no sho.

Ezampu of dia tok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Two smol pikin wit long rope wey dey abaut 12 feet (3.7m) fom diasef go dey ton dey rope as oda smol pikin dey enta jomp di rope.

Jomp in, Jomp out[chenj-am | chenj-am for orijin]

Charlie Chaplin went to France

To tich di ladies hau to dance.

Fest di heel, den di toe,

Den di splits, an around you go!

Salute to di Kaptain,

Bow to di Queen,

An torn your bak on di Nazi submarine!