Sir Darnley Alexander

From Wikipedia

Sir Darnley Alexander[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sir Darnley Alexander, QC, SAN, GCFR (28 January 1920 – 10 February 1989) him be Naija Jurist and former Chief Justice of Naija. Dem born am for Castries, St Lucia on 28 January 1920. Him go University of London and nah dere him take get Bachelor of Law degree for year 1942. Him con work as crown counsel and legal draftsman for Jamaica as magistrate for Turks and Caicos Islands. Him come Naija for year 1957 wen de premier for de Western Region tell am make him come. Obafemi Awolowo dat time don beg de Colonial Office for London say make dem help am find legal draftsman; Alexender come work for de region for different capacities wey him fit. Him be Legal draftsman for the Western Region Naija for year 1957 – 1969 and him come be de acting Director of Naija Public Prosecutions for year 1958. For 1969 dem choose am as de Solicitor General and Permanent secretary for de regional Ministry of Justice, for year 1963, dem make Queen Counsel. For 1964, dem choose am make him be Judge for Lagos High Court and wen e con reach 1969, dem choose am make him be de Chief Justice for South Eastern State wey be Cross River and Akwa Ibom State now. Dem Choose am as Chief Justice for 1975 over dem de senior members for court. Wen him still be Judge, Dennis Osadebay choose am say make him be commissioner wey go torchlight de Owegbe secret cult, him still be de chairman wey dey oversea de Tribunal wey dey torchlight de examination wey leak comot. Wen him retire, him come be de chairman for Commission wey go rearrange Naija Law.

References[chenj-am | chenj-am for orijin]

<1.https://www.google.com/search?biw=1600&bih=794&tbm=bks&ei=En9PW8LZCIOdsgGNsZyIAg&q=Darnley+Alexander+February+10%2C+1989&oq=Darnley+Alexander+February+10%2C+1989&gs_l=psy-ab.12...6986.6986.0.7852.1.1.0.0.0.0.165.165.0j1.1.0....0...1c.2.64.psy-ab..0.0.0....0.-QyDK0byaDw /> <2.https://en.m.wikipedia.org/wiki/Darnley_Alexander#cite_ref-2 /> <3.http://www.nigeriaintel.com/2012/07/05/as-nigeria-gets-first-female-chief-justice-a-profile-of-justice-mariam-aloma-muktar /> <4.https://en.m.wikipedia.org/wiki/Darnley_Alexander#cite_ref-4 /> <5.Kamil, M. (1995). Rendez-vous--: An authorized biography of Chief Justice Mohammed Bello. Ikeja, Lagos, Nigeria: Malthouse Press. pp. 253-254 />