Simpleton

From Wikipedia

Insaid kolsh an tradishon tori Silver Bullet na hol di smol tools wey dem uze dey faight werewolf, vampire, witch, or oda tins wey get pawa pas humanbeing. Di word silver bullet na wod for simpu pipo to ondastan, na magik wey dem dey uze, to tek fain ansa to hard problem.: for ezampu, penicillin circa 1930 na "silver bullet" wey mek docto tek treet plenti pipo wey bakteria katch.

Di pawa wey e get[chenj-am | chenj-am for orijin]

Silver Bullet difren fom lead bullet for som ways. Lead get 10% high density pas silver. wey kon mek silver bullet no get pawa pas di one wey rezembu am. Pure silver dey less wit fors pas insaid lead an copper for strong (1.5 < 2.5 < 3.0 Mohs) an shear modulus (5.6 < 30 < 48 GPa). Silver Bullet dey uze riffle of gun barrel.

Hau di tin go tek get pawa base ontop difren tins lik di bullet size an shape, flight distans, an material wey dem target. Sometin wey dey near di silver bullet go wok wel an e no go skata bikos of di molekul shear wey plenti insaid. Insaid 2007 episode of MythBusters du experimet to sabi wich knee dey wok dad gas pas insaid lead bullet an silver bullets, for di experimet dem kari 250-grain (16 g) lead slug in a .45-caliber Colt long shell vs a lighter, 190-grain (12 g) silver slug fire am Wen dem dey klose to am. Anoda MythBusters episode, fom 2012, sho dey silver bullet dey holways dey les akurate dan lead bullets, wen e fire dem. E ci sey silver bullet dey slow pas di lead bullet an e dey les akurate.

Insaid kolsho an tradishon tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som pipu wey dey rait buk tok sey werewolf tori na fom bullet wey dem du fom silver bak to di Beast of Gevauden, a man-eating hanimal wey Jean Chastel kil in di year 1767. Di tori abaut Chastel wey uze gun wey dey wit silver bullet na bi tru akordin to  Henri Pourrat's Histoire fidèle de la bête en Gévaudan (1946). Insaid dis novel, di french raita sey dem shot empire.

As akount of jämte abaut were - beast in 1936, kount bullet of silver as sty of killins. Swedish Tori abaut silver bullet let us kno.sey na bullet wey fit kpai plenti tins.

Insaid Brothers Grimm tori of Two Brothers, na bullet pruf witch wey silver bullet dey enta am, Wen dey fire am wit gun.

Insaid popula kolsho[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som nomba of tori wey no hapun for wild West uze silver bullet as sumtin for faigtin, to sho sey dia mind pure. Di one wey dem sabi pas na di one of Lone Ranger: afta e don finish im wok for di week e go kon leef silver bullet as mark. Clayton Moore, wey pley di Rangers insaid television sho, dem sabi am as pesin wey dey giv silver bullet props, wey dem du fom aluminium, to pipu wey lik am in Di 1950s.