Simon Onwu

From Wikipedia

Dr Simon Ezevuo Onwu (28 December 1908 - 4 June 1969) na Naijá dokto an im bi di nomba one pesin wey bikom dokto from Ibo pipul.

How im tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born am for 28 December 1908 for Udi Lokal Govment Area wey dey for Enugu State. Im bi di pikin of Chif Amadi Onwubunta an Madam Nwalute Onwubunta wey kom from Amozolla Affa wey dey for di same Udi Lokal Govment Area.

How im tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Simon stat pramari skul for St. Mary's School for Onitsha where im grow as Catholic. Afta im finish skul there, im go Wesley Boys' High School for Lagos bifor im kom go King's College for di sem Lagos. E no finish im sekondri skul for Lagos bikos e folo Chif Onyeama Onwusi as im pesona asistant go United Kingdom. E leta go bak to Britain for 1925 to go skul an for 1927 e kolet im London Matriculation Certificate.

How im tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dr. Simon Onwu kom bak to Naijá for 1933 an join di Colonial Civil Service as junio medikal ofisa for Port Harcourt where im wok for 2 years.

Where dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]