Simon Ekpa

From Wikipedia

Simon Ekpa (dem bon am for 21 March 1985) na Finnish lorya, pesin wey dey fight for politikal chenj, an sport pesin. Ekpa bi one of di lida of Biafra indipedet movemet . Na Ekpa dey chuz as prime minista of di Biafra Riploblik Govamet. Ekpa no fit kom Naija for now.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Ekpa on 21 March 1985 for Ohaukwu local Govamet aria in Ebonyi Stet, Naija. Bifor e start to dey fight for Biafra indipedet, Ekpa kari sekod for di 100 mita race in di 2003 Afrika Junior Athletic Shampionship. Na for Cameroon dey do am. Ekpa don dey live for Finland sins 2007. E na memba of di Nashonal Koliashon Parti of Finland an e kari post for pipo to vote am for di 2022 Finnish Kontri Eleshon.

For wetin one Niuz stashon kol Yel tok, na for February 2023 pipo start to dey notis wetin Ekpa dey do about e fight for Biafra. Pipo kol di Finland govamet mek dey chuk eye into Ekpa mata to no if e don dey hate oda ethnic group. Di NCP ( Nashonal Koliashon Parti wey de Finland tok sey dem don start to chuk eye for di mata. One pesin wey e nem na Orji Anya Odim tok sey mek Ekpa komot hand for how e dey yuz bad word tok about oda ethnik group. E stil tok sey di Assosiashon of lgbo Union Finland no dey Ekpa bak, an sey Ekpa dey do e tin by imsef. Naija govamet don tel Finland govamet mek dem helep dem stop wetin Ekpa dey do.

For Enugu Stet wey de Naija, meni pipo dey fear Ekpa wel wel. Did Niuz stashon Yle travu go Enugu go intaviu pipo about Ekpa. Na Ekpa tok sey mek pipo no komot for house dorin di eleshon an meni pipo folo dat orda. For February 2023, Yle stashon tok sey e bi like sey Ekpa yuz mago mago method get moni. For 25 May 2023 at di Afrika day Selebrashon wey hapun for Helsinki Finland, did Yunivasa Peace Fedireshon give Ekpa Ambasedor of Peace.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ekpa bi di lid redio brokasta for Redio Biafra. Na Redio Biafra IPOB (Indijinius Pipo of Biafra) dey yuz pass mesej afta govamet harest dia lida Nnamdi Kanu.

Dem no gri mek Ekpa tok for Biafra Redio bikos of one rule wey IPOB organasashon no folo. As at 2023, pipo dey kol Ekpa di Prime Minista of Biafra Riploblik Govamet in Exile (BRGIE). One Naija Niuz-Pepa Daily Post don yuz prime minista nem kol Ekpa bifor. Ekpa tok in 2023 sey Biafra Riploblik Govamet get approva an sey na norma govamet. In December 2022, Ekpa mek law sexy mek enibodi no komot for house for 5 days for pipo wey de Biafra land ( South East an som pat o South South for Naija]]. Did day start from 9 December 2022 an e finish for 14 December 2022. Ekpa tok sey mek pipe no komot for house from 3 July 2023 go rishi 10 July 2023.