Siminalayi Fabura

From Wikipedia

Amaopusenibo Siminalayi "Sim" Joseph Fubara (dem bon am on 28 January 1975) , na di Govnor of Rivers Stet. E don sarf as akountant genera of Rivers Stet, Nigeria. Dem bon am for Opobo Town wey dey Opobo-Nkoro Lokal Govment Aria of Rivers Stet.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for Opobo Town wey dey Opobo - Nkoro Lokal Govmet Aria of Rivers Stet. E go Opobo Primari Skul an stil go Comprehensive Sekondri Skul, Opobo bifor e go stodi akountin for Rivers Stet Universiti of Science an Technology. E get MBA an MSC insaid 2013 an 2016 fom di Universiti of Port Harcourt.

Wok e du as Govnor[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sim Fabura sign N195.3bn kontrat wit Julius Berger mek dem tek du Port Harcourt Ring Road. Di govnor tok sey e don pay N150 billion fest for di wok.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sim stat wok in 2013 as akountant wit di Rivers Stet Sinior Sekondri Skul Board. E wok as direkto of finance an akount for di Stet govmet haus in 2015, an rish di posishon of pamanet secretary in March 2020. E get apointmet as Rivers Stet akountant genera on December 23, 2020, rish May 2022, wen e win di People's Democratic Party governoship primari for di 2023 general eleshon. E bi memeba of Nigerian Institute of Management, memba of Association of National Accountant of Nigeria.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fubura na sekond pikin of di five pikin an fest son wey Late Joseph Fubara bon, wey bi bifor bifor solja wey don du plenti pratis, an Late Love Fubara, wey wok for govmet. E get post for St Christopher (KSC) order of Church of Nigerian Anglican Communium. Na im bi di Amaopu-Senibo of Opobo Kingdom. E Mari Valeria Fubara an dey get three pikin.

Wia dem gada tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Rivers ex- Accountant General Siminalayi clinches PDP governor ticket. Punch newspaper, 25 May 2022. Retrived 2023-08-09.

2. Despite being declared wanted by EFCC, former Accountant-General wins PDP governor primary. Premium Times, 26 May 2022. Retrived 12 December 2022.