Silver bullet

From Wikipedia
A prop silver bullet, wey Lone Ranger yuz

In tradishonal old tori, a Silver bullet na one of di instrumet wey fit kil vampaya, witch, or oda livin tins wey no bi human bein. Silver bullet fit stil min wen pesin get simpu ansa to hard problem. One medisin wey bi Penicillin bi silver bullet bikos doktor yuz am tekia of plenti pipo wey get bateria sikness.

How dem dey yuz am for old tradishonal tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni pipo wey dey rait buk tok sey, di hidiya sey bullet wey dem mek with silver fit kil vampaya an witch don dey pipo mind sins di kilin of Beast of Gévaudan. Beast of Gévaudan na one hanima wey dey chop human bein. Na Jean Chastel Kil di hanima in 1767. But di hidiya sey na gun wey get silver bullet r yuz Kil di hanima kom from di mis-ondastandin inside di buk Histoire fidèle de la bête en Gévaudan. Na Henri Pourrat rait di buk in 1946. Di buk tok sey na di virgin Mary shain wey Jean Chastel gum for e kap e yuz Kil the hanima. Jean Chastel melt di shain to fit yuz am mek bullet. Some old tori wey Sweden pipo dey tok sopot am sey na silver bullet fit kil vampaya an evil hanima wey dey chop human bein. Di tori stil tok sey no witch or vampaya fit live wen silver bullet hit dem. For di tori wey Brothers Grimms dey rait wey get di tahitu The Two Brothers tok sey, hodinari bullet no fit kil witch onless dey yuz silver bullet. For some tradishonal old song, Delyo wey kom from Bulgaria no fit kpai onless dey yuz silver bullet. Deylo dey fight govamet dat time.