Sidney Robertson Cowell

From Wikipedia

Sidney Robertson Cowell ( e nem wen dey bon na Sidney William Hawkins. Dey bon am June 2, 1903 an e kpai February 23, 1995) na Amerika wuman wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek dia muzik an e dey kolet an kip tradishonal song. Sidney bi di wife of di muzik komposa Henry Cowell.

How e tek stat life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Sidney Robertson Cowell in San Francisco in California on June 2, 1903. Sidney papa na Charles Albert Hawkins an e mama na Mabel Hawkins ( e nem bifor e mari na Morrison). Sidney go rid Romans Langwej an Filosofi in Stanford Yunivasiti. E kolet e B.A satifiket in 1924. Na in 1924 Sidney mari Kenneth Robertson, way bi a medikal studet. Afta di marej, dey go Europe. In 1925, Sidney enta "École Normale de Musique" wey dey Paris to rid piano wit Alfred Cortot. Wen e kom bak to California, Sidney tish for di "Peninsula School for Creative Education" in Menlo Pak, Kalifornia from 1926 go rish 1932. Dorin dat time wey e dey tish, Sidney stodi how to sabi muzik tins wit Ernest Bloch an e an e hosband still go len how oda kolsho wey no bi Europe dey mek dia muzik at di San Francisco Conservatory Music. Afta wey e marej wit Kenneth Robertson skata in 1934, Sidney pak go New York City an e hep daret di Sosha Muzik Program at di 'Henry Street Settlement" on di lowa East side. E wok wit one eldali Jewish wuman. Sidney wok as Assistant for Charles Seeger in 1936. Charles Seeger na di teknikal advaisa of di yunit of di Spesha Skills Divishon of di Risetumet Administrashon in Washington ( dey leta chenj di nem to Farm Sekihoriti Administrashon). Na wen e stat to wok as assistant e dey kolet an rekod tradishonal muzik in Appalachia, di Ozarks an di hopa Midwest. Sidney leta go bak to Kalifornia wey e stat an arenj mek di Librari of Kongress, di Yunivasiti of Kalifornia, Berkeley an di Wok Progress Administrashon of di Norta Kalifornia Folk Muzik Projet sponsor e projet wey wan du. Sidney kom bi di daretor of di projet from 1938 go rish 1940. Na 20 wokas dey wok onda am dat time.