Shola Allyson

From Wikipedia
Shola_Allyson_(1)

Shola Allyson-Obaniyi wey pipul no wel wel as Shola Allyson or Sola Allyson na Naijá gospel singa.E dey popula afta e du one Albom wey bi Eji Owuro for 2003.Na dis Muzik dem tek du muzik for di fim wey bi Eji Owuro sef.Afta Eji Owuro, e kom du anoda 'Albom wey bi Gbeje F'ori, Ire, Imoore wit plenti plenti Albom wey kom folo. Allyson song wey pipul Sabi wel wel plenti, som of dem bi Eji Owuro, Obirin Ni Mi, Aseye, Isinmi. No bi onli to sing na e Allyson dey du bot e na voice traina too for muzishian wey dey sing.Allyson dey sing for pipu wey dey du Fim too an dis one na muzik kova.

Tori of e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Ikorodu wey dey Lagos State dem bon am in di 1970's.Allyson kon go Anglican Primary School Ikorodu, afta dat one e kon go Sham-el-deen Grammar School, Ikorodu.E kon stil go anoda skul wey bi Government Technical College Agidingbi, Ikeja go rid Business Study an mek am NBTE Certificate.For 1997, Allyson enta Ibadan Polytechnic to rid muzik teknorlogi an e get Higher National Diploma (HND) degree wit beta grad wey bi opa kredit.

Na Muslim pipu bon am bot em go plenti choch laik CCC Olushesi parish (apata igbala) iju ishaga wey bi one of dem.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Allyson fest du bak-up-singa in 1980s an dat taim e na 13 years. E kom stat to dey du bak-up-singa for muzishian like: Yinka Ayefele,Gbenga Adeboye,Pasuma, Obesere, wit Daddy Showkey. Na for insaid bos Allyson tek get hep as e mit pesin wey get di movie script an di pesin folo am tok about di fim kol Orekelewa.Na so Allyson kom lẹta folo sing for di sound trak of di fim.Dis tin wey Allyson du mek Dem chenj di nem of di fim to Eji Owuro. Wen dem finish di fim Eji Owuro, di studio kom chuz to du ful music album for di fim. Na dis albom mek pipu for muzik indostri no Allyson.

Pasona laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Allyson du marej in March 2003. Na for chorch e tek mit e hosband Toyin Obaniyi. Togeda dem don bon 3 pikin: Ayobami, Mopelola wit Obafunmiwo.

Di muzik wey e don du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Eji Owuro(2003)
  • Gbe je F'ori(2005)
  • Ire(2007)
  • Im'oore(2009)
  • Adun(2012)
  • Ope(2015)
  • Imuse(2018)
  • Iri(2019)
  • Isodotun(2021)