Shina Peters

From Wikipedia

shina Peters (bon 30 May 1958) na Naijà juju singa.


How E Tek Stat Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Oluwashina Akande Peters im papa an mama nem am. Im kom fom Ogun State for Naija. Na smol pikin im tek stat im muzik karia wen im dey du song wit im padi dem wey dey onda Oluwashina And His Fantastic Brothers, dat time wey im dey wit im frend dem im len how to sabi pley Piano wel wel, im kon dey wit dem Ebenezer Obey's Band.Afta dat one im komot for Obey Band kon go General Prince Adekunle's Band as pesin wey dey pley Guitar. Adekunle's Band dem kon du sho for Legos big plez like di Western Hotel, Palm Beach Hotel an Executive Hotel.som time wey Adekunle bodi no dey kakaraka na Peters dey du di sho as a singa.Na leta em kon go du im own wit Segun Adewale.Di two of dem dey togeda dey du plenti album for 1980's,afta dat one Shina kon go du im own band wey bi, Sir Shina Peters & His International Stars. Peter na aktor too em art for Money Power wey Ola Balogun du. Im dey mari Clarion Chukwurah wey dey du fim. Dem bon pikin wey bi Clarence Peters.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sir Shina Peters wit im International Stars du their fess song wey dem dey kol albom for 1989 (Afro juju Series 1), Dem du di albom onfa CBS Records of Nigeria.Ace, wey bi song wey Laolu Akins du. Na song wey dem use juju an Afrobeat du. pipu sabi di song wel wel, wey mek dem tek kol im nem for pesin wey win awod as Artist of the Year an Album of di Year . Afta dat one em kon du anoda wey bi anoda 'Shinamana', dat Album get som song lik 'Oluwa Yo Pese', 'Omo Bo' an 'Give our Women Chance'. Sir Shina Peters don get 16 albums wey em don du lik this.

Som Of m Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Way to freedom

.Freedom (1980)

.Money Power (1981)

.Ko Temi fun mi (1982)

.Sewele (1968)

.Ace Afro Juju Series (1989)

.Shinamania (1990)

. Dancing Time (1991)

. Experience (1992)

.Mr President (1993)

.My Child (1994)

.Kilode (1995)

.Love (1996)

. Reunion(1997)

.Playmae (1999)

. Happy Hour (2001)

.Pay Back Time (2005)

. Splendor (2006)

. Do one for Me (2012)