Shanno Khurana

From Wikipedia

Shanno Khurana (dem bon am for 22 December 1927) na one klasika vocalist an komposa,India pesin wey pipul know wel-wel from Rampur-Sahaswan gharana of Hindustani klasika muzik. Shi disaipu of doyen of di gharana,Ustad Mushtag Hussain Khan"(d.1964),Meni pipul know sey shi sabi hau to pafom one kind bandish an ragg wey no komon,even as e bi sey di kind song wey shi dey sing na Khayal,tarana,thumri,dadra,tappa to chant an bhayan.Na Jodhpirnaim dem bon an na die shi gro,shi statto dey sing on top al India Radio for 1945 for Labore,an shi kom shift for sing for Delhi an shi kontiniu to dey on top al India Radio Delhi an for konsatbdem an for muzik festiva.Shi stat Muzik Edukeshon, an shi kom get M.Phil an PhD for muzik fro di Kairragarh Yunifasiti an shi don do meni-meni risash dem for folkmuzik of Rajasthan. Dem giv am Padma Shri awod fo kOkkr 1991,dem kom stil gov am di Padma Bhushan awod for 2006,wey bi di nomba three hayes honor wey India go ment for giv sivilian.For 2002,dem giv am Sangneet Natak Akademi fellowship hono wey bi di hayes hono for performing Arts an na India Nashona Akademi for muzik,Dans an Drama dey gov di hon of Sangeet Natak Akademi hono.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Khurana inside Punjabi famili for Jodhpur, Rajasthan.Meni pipul for im famili no bi muzishan,bot Meni of dem dokto dem,enginia dem,an pipulwey dey wok for foreignsavis dem bot shi stat to dey get intres for muzik wen shi stil bi smol pikin for di time wey shi see sey im broda as e dey len from musicologist an vocaliat Pandit Raghunath Rao Musalgaonkar,an disaipu an nephew of Raja Bhaiya Poonchwale of Gweiliar gharana.Im coservative famili no giv am shans to len muzik,wen Im fada kom see sey shi dey hie klasika muik wel-wel for radio, e mom alau am mek shi dey len muzik from Musalgaonkar wen shi stil bi 12 yias old.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Khurana mari one dengist wey dey wok wit Indian Air Force wen shi bi 18 yias old an kom shift go Lahore, an for Al dis time shi stil dey sing for Al India Radio,(AIR),Lahore,sins 1945.Aftavdem poshon India,Im famili shift go Delhi,an im hosband kom liv Air Force wok kom stat to dey do im wok.Im hosband kom push so tey shi stat to dey do im riyaz again even as shi don get two smol-smol pikin an even di Moda-In-law dey sik dat time. Shi dey do pratis wit Maestro Pandit Chatur Lal,an dem gogeda for 17yiaa an shi stil dey sing on top Radio.Nirmala Jooshi,wey bi di Sekitri for Sangeet Natak Akademi kol sey mek shi kom dey Tish klasika Muzik for di muzik Skull wey dey for Sangeet Bharati for Mandi Haus for Delhi. Afta som time, Im hosband introdus am to one musicologist an shif produsa of AIR,Delhi; Thakur Jaidev Singh an dis pesin na Im hosband peshent.Singh kpm Hep am het konfidens wel-wel an shi kom stat to dey travu go Turkey,Iran, Greece, an oda aria dem as pat of kulsho deliget an na India govment dey sponso evri tin.an shi stil pafom for big-big muzik festival dem for India for 1960 an 70 dem like Tansen Summelan, Gwailor,Harvallabh Festival,Jalandhar,and Swami Haridad Sangeet, Sammelan, Mumbai.Di man even Tish am Putan-anh Thumr,an kom stil tell am sey mek shi join di India Kala Sangeet Yunifasiti of Khairagarh,Madhya Pradesh,Wie eminent musicologist an Tisha ,S.N Ratanjankar dey an don dia as Prinsipa of Bjatkhande muzik Institut an im bi di Vais-Shanselo for dat time.