Segun agbaje

From Wikipedia

Segun Agbaje (born 1964) be the oga kpatakpata for Guaranty Trust Bank (GTBank), wey be one financial institution for Nigeria. Him also be Director for PepsiCo plus member of Mastercard Advisory Board, Middle East and Africa.

Education[chenj-am | chenj-am for orijin]

Segun Agbaje been attend secondary school for St Gregory’s College, Obalende, Lagos State, Nigeria, plus including St Augustine Academy, Kent, for England. Him from there go University of San Francisco, California,for inside United States of America where him get Bachelor of Accounting plus Master of Business Administration degrees.

Career[chenj-am | chenj-am for orijin]

Segun Agbaje start him career for Ernst & Young inside San Francisco for America and him comot in 1991 to join GTBank. Segun Agbaje come rise to becom Executive Director for January 2000, and Deputy Managing Director for August 2002. Dem make Agbaje Acting Managing Director inside GTBank for April 2011 when Tayo Aderinokun, the oga kpatakpata been take medical leave to go treat himself. Dem name Agbaje as the new oga kpatakpata of the bank in 2011 after Tayo Aderinokun die of lung cancer. Dem elect Agbaje inside the board of directors and audit committee of PepsiCo for 15 July 2020.

Awards wey GTBank don win under Agbaje's leadership include Best Bank in Nigeria by Euromoney; African Bank of the Year by African Banker Award; Best Bank in Nigeria by World Finance UK; Most Innovative Bank by EMEA Finance; Best Banking Group by World Business Leader Magazine and Best Bank in Nigeria award by the Banker Awards.

Personal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Segun inside the family of Chief Julius Kosebinu Agbaje, wey be banker and Madam Margaret Olabisi Agbaje, wey be teacher. Na him elder brother be People's Democratic Party Lagos politician, Jimi Agbaje.