Samuel Ajayi Crowther

From Wikipedia

Samuel Ajayi Crowther na Naija pesin wey sabi plenti langwej, na Pasto I'm bi an na im bi di fest Afrika man wey bi Anglican Bishop of West Africa. Dem bon am for Oshogun, wey kom bi (Ado-Aweye of Oyo State, Naija). Ajayi na twelve years old wen slave pipu kari am and im family. Dis tin happun wen Yoruba pipu dey fight,for d owu war for (1822 - 1829) wey dem scatter im village (oshogun) Dem lata sell Ajayi Crowther to pipu we dey buy and sell slave for Portuguese,[3] wey dem put am on top boat for water wey dem call Atlantic,to go New world. Dem later free Ajayi from slavery for coastal port for d Royal Navy's west Africa squadron,wey dey Force d British ban against the Atlantic slave trade. D people wey dem free,go Sierra Leone,go stay. For Sierra Leone Ajayi begin dey call him name Samuel Crowther,he con start skool with English. he turn Christian and Sierra Leone country persin. He con turn big persin for Krio Ethnic Group. He con sabi read different languages,so dem pick am as minister for England, where he later collect doctorate degree from Oxford university. He prepare Yoruba grammar, con change d Anglican buk of prayer wey everibodi know to Yoruba,he don dey turn the English Bible to Yoruba and Even many languages.Crowther mari his skool student, Asano (i.e. Hassana; wey be Muslim bifor bifor), baptised Susan. She b di persin wey dem relise from a Portuguese slave ship as Dem talk am in Crowther's 1837 leta