Sam Uzochukwu

From Wikipedia

Sam Uzochukwu (Dem bon am for 1940) na Naija pesin wey go skul wel wel an e no plenti tins abaut Igbo Oral Poetry.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Uzochukwu for 1940 for Ebenato wey dey for Nnewi South Lokal Govament Aria for Anambra Stet in Naijá. Afta e get B.A. Degree in English Language fom Obafemi Awolowo University, Ile Ife for 1966, e enta go Igbo Studies. Uzochukwu get e PhD fom University of Lagos for 1982 for one thesis wey e rait on Igbo oral literature. Uzochukwu tish for University of Lagos wie e bikom Professor an Head of the Department of African and Asian Studies. E don wok to kolet and kip rekod abaut Igbo oral poetry an du wok-dem in e for buk.

Uzochukwu na di fest pesin to bikom Professor for Mbanese. Mbanese na di nem wey dem dey kol five komuniti for Nnewi South Lokal Govament Aria wey dey Anambra Stet. Di komuniti na Ebenato, Ezinifite, Akwaihedi, Osumenyi an Utuh. For 2019, Prof. Uzochukwu stat one Tertiary Education Foundationan e rilis di buk wey e rait abaut e land wey e kol A Single Palmnut.

Wok wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Mbem Akwamozu [Funeral Dirges], 1985Point go mistek: Invalid <ref> tag; refs with no name must have content
  • Akanka, Na Nnyocha Agumagu Igbo [Criticism of Igbo Poetry], 1990
  • Abu Akwamozu [Songs of Mourning], 1992
  • Traditional funeral poetry of the Igbo, 2001
  • Traditional birth poetry of the Igbo, 2006
  • A Single Palmnut, The Autobiography of Prof. Samuel Udezuligbo Uzochukwu, 2019.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]