Saleh Mamman

From Wikipedia

Manmman Kwagyang Saleh (dem born am for 2 January 1958),na one gofment ofisha wey work as Minista of Power from August 2019 go rish September 2021. Na Muhammadu Buhari swear am put for ofis on 21 August 2021, an na stil Buhari komot am for ofis kom yuz Abubakar Aliyu wey bi Minista of Stet for Works an Housing tek reples am.

E Life Wen E Dey Smol an Hau E go Skul

Saleh kom from Taraba Stet. E get Higher Nashona Diploma for Eletrika Eletronik from Kaduna Politeknik an na 1988 E graduat from de skul. E stil get MBA for Bisnez Adminisreshon from Bayero Yunifasiti Kano,an na 2015 E graduat komot from di skul.

Hau E Work

Saleh stat to dey work as Tisha for Teknika Skul ,Mubi for Adamawa Stet. For 1992, E stat to dey work for Taraba Stet. Dem promot am to Assistan Daretor for de Ministri of Works for Taraba Stet an E ritaya for 2002. Afta E ritaya,E kom bikom Biznezman an Politishan.