Ruth Kadiri

From Wikipedia

Ruth Kadiri (dem bon am for 24 March 1988) na Naija aktres, screenwriter an fim produsa.

How shi tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ruth Kadiri wey dem bon for Benin City, Edo State,Edo State, Naija. Shi stodi mass communication for University of Lagos and Business Administration for Yaba College of Technology.

Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di aktress keep ha relationship mata secret until December 2017, wen Ruth announce sey shi don engage on top ha social media pej. On August 26, 2020. Kadiri celebrate ha daughter one year birthday.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ruth Kadiri enta Nollywood for di fim wey di nem na Boys Cot and sins den shi don du over fifty fim. Shi don write and co-write plenti movies Matter Arising, Heart of a Fighter, Ladies Men, Sincerity, First Class and Over the Edge.Shi produce some fim wey talk abaut lie and pipu wey dey deceive like Somebody lied and Memory lane.

Fim wey im dey[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • In Your Arms (2017)
  • Black Bride (2017)
  • We Cheats More (2017)
  • WET by Ruth Kadiri (2018)
  • Tripod by Ruth Kadiri (2018)
  • Black Men Rock (2018)
  • Love is Beautiful (2019)
  • The Dumb Wife (2020)
  • Too Old for Love (2020)
  • Tears of Rejected Seed (2020)