Rulan Chao Pian

From Wikipedia

Rulan Chao Pian (dem bon am for April 20, 1922 an e kpai for November 30, 2013) na wuman wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik an professor of Chinese langwej an [Literature| Litireshon]]. Rulan Chao Pian bi one of di fest ten wuman to Hi full professor in di Falkoti of Arts an Sayens at Harvard Yunivasiti.

How e tet stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for April 20, 1922 dey bon Rulan Chao Pian inside a big Chinese famili. Pian Papa Yuen Ren Chao stodi langwej.Pian mama Buwei Yang Chao na doktor an e also dey rait buk.Pian perent don dey stey for Cambridge sins 1920 bikos e papa get wok at Falkoti at Harvard Yunivasiti. Pian famili leta travul go China an France, but kom bak to "United State" .Di famili stil go Hawaii, New Haven, an Washington D.C. Wen Pian still dey yong, e lens to play piano skol but bikos of e famili travul travul, e no easi for Pain to fit len am wel. Pian enta Radcliffe Kolej wia e tek kolet e Bashelo of Art an e Masta of Art in muzik histri (Westa muzik) in 1943 ( na 1944 de e satifiket) an 1946 for e Masta. E kolet e Ph.D in East Asia Langwej and in Muzik in 1960. Some of di pipul wey tish am abaut muzik na "Doc" Archibald T. Davison, Edward Ballantine, A.Tillman Merritt, John Ward, an Walter Piston. Pian fest tish at Harvard Yunivasiti as tishin assistant from 1947 onti e kom get promoshon as instructor an leshura. In 1947, Pian bikom professor in di Dipatmet of Muzik an di Dipatmet of East Asian Langwej an Sivilisashon. Pian bi one of di three fimeli professor in di Harvard Muzik Dipatmet an one of di thirteen in di hol Falkoti of Arts an Sayens wey dey no fit komot onti e ritaya.