Jump to content

Rukayya Umar Dawaiya

From Wikipedia
Rukayya Umar Dawaiya
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1985 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokHausa langwej Chenj-am
Wok wey e dey duactor, film actor, film producer Chenj-am
Wie e go skulBayero University, Kano Chenj-am
Academic majormass communication Chenj-am
Wie e dey livKano Chenj-am

Rukayya Umar Dawayya (bon 17 October 1985) shi bi Kannywood aktress for Naija, shi kom from Kano Stet ,Naija.

How shi tek stat life and skool

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rukayya Umar Dawayya bon 17 October 1985 and shi kom from Kano. Ha papa na bizness man from Matazzu, Katsina stet and ha mama na from borno stet, Dawayya du ha primari and sekondri school for Kano, where shi kollect ha certificate in Arabic langwej. Shi con still kollect National Diploma in mass communication for Bayero Universiti of Kano.

Rukayya Umar Dawayya du ha fest fim for (2000) and di nem of di fim na Dawayya dis fim mek ha popula so tey pipu dey kol ha Dawayya. Na dis fim mek ha continue to dey mek fim, shi don du ova 150 fim for Kannywood fim industri . Dawayya na ambassador to som kompany inside and outside Naijá. Shi bi politician and biznes wuman.

Ha persona Life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dawayya marri for (2012)but di marriage scatta for (2014), shi bon one pikin wey bi boy for Mecca, Saudi Arabia