Ruby Terrill Lomax
Ruby Terrill Lomax ( dey bon am in 1886 an e kpai in December 28, 1961) na Amerika wuman wey bi tisha an e na pesin wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Terrill join hand wit e hosband John A. Lomax to rekod an kip Amerika tradishonal songs. E stil hep to mek pipul no di impotant of mek Wumen go skul an e na "Dean " for wumen edukeshon at Yunivasiti of Texas in Austin
How e tek stat life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Denton, Texas wey de United State just outside Dallas dey bon Ruby Terrill. E get digri for Stet Kolej. Ruby Terrill mek rekod as di fest wuman wey get hi-yest 1 at di Yunivasiti of Texas. Wen Terrill see sey na tisha e go like to bi in life, e tish for sekondri skul wey de vilej side an di sekondri skul wey de siti for di Stet wey e de. E still tish for kolej wey de e Stet. E yuz di moni wey e get from dis tishin job tek sopot e sef as e kontinu to rid for yunivasiti. Di sponsor moni wey e get as e wan len Latin from 1914 to 195 hep Terrill to fit get Ph.D in Klassikal Langwej. Di moni wey e get as e dey du holiday lesin for four years at di Yunivasiti of Chikago an two years at Kolombia Yunivasiti hep sopot too so dat e go get e Ph.D.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Terrill Kolet e M.A sartifiket in klassikal langwej from Kolombia Yunivasiti. Wetin Terrill go rid na Latin but e stil get smol nolej in Greek afta wey dey mek am di "Dean" of women hasosiate professor of klassikal langwej at di Yunivasiti of Texas in Austin. Wen e still dey wok for di yunivasiti, Terrill join as memba to lokal, nashonal an intanashonal sosaheti. Di student wey de Yunivaasiti of Texas no am we'll we'll bikos of sey de jentu, nice an e dey always laff wit dem.