Romelu Lukaku

From Wikipedia
Romelu Lukaku
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromBelgium Chenj-am
Country for sportBelgium Chenj-am
Orijina nemRomelu Lukaku Bolingoli Chenj-am
Fest nemRomelu Chenj-am
Famili nemLukaku Chenj-am
Wen dem bon am13 May 1993 Chenj-am
Ples wey dem bon amAntwerp Chenj-am
PapaRoger Lukaku Chenj-am
Broda an sistaJordan Lukaku Chenj-am
Fest langwejDutch Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokDutch Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Position played on team / specialityforward Chenj-am
Member of sports teamA.S. Roma Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am
Sport number90 Chenj-am
Participant in2014 FIFA World Cup, UEFA Euro 2016, 2018 FIFA World Cup, UEFA Euro 2020 Chenj-am
LeaguePremier League Chenj-am

Romelu Lukaku Bolingoli dem bon am for 13 May 1993). na Belgian ogbonge futbolar wey dey pley for Seria A klub Inter Milan, na loan e dey fom Chelsea.

Lukaku stat to dey pley for sinior klub wen e dey Anderlecht, wia e win Belgian pro League an na im skore pas for di league. In 2011 e join Chealsea for transfer wey rish £10 million (€12 million), bikos e no dey pley wel wel dem loan am go West Brommich Albion an Everton; in 2014, Lukaku sign for Everton for moni wey rish €28 million, (€32million), na im bi di sekond playa wey skore pas. E pley for Manchester United afta dem buy am wit moni wey rish €75 million (£88 million), afta dat one e kon go Inter Milan in 2019 for moni wey rish €80 million (€68.1 million), wen e no kon setu wel for di klub, e go Inter Milan in 2009, for deel wey rish €80millon (£68.1 million). for di klub e win Serie A league an Serie A Most Valuable Player.

In 2021, Lukaku go Chealsea bak for insaid deel wey rish €97.5 million (€115.7 million), wey mek mek am seventh playa wey cost pas. di Belgian playa wey cost pas an playa wey cost pas for dat season.

Belgian playa wey don skore pas, Lukaku stat to dey pley for Belgium sinior team in 2010, an don sho for di konti insaid five competishion:di 2016 an 2020 UEFA European Championship an di 2014, 2018 an 2022 FIFA Wod Cups. Na im win Bronze booth in 2018.

Im klub wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau e tek stat

Lukaku Join Rupel Boom wen e dey five years old. After four season for Rupel Boom, pesin wey dey holways fain playas for Leise ci am kon kari am go dia youth academy. E pley for Lierse fom 2004 go rish 2006, e skore 121 goals insaid 68 match. Wen Lierse relegate, Anderlecht kom buy am go dia klub. Na three years e uze pley as youth playa for Anderlecht, e skore 131 goals insaid 93 match.

Im Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon in Antwerp,. Belgium to Congolese papa an mama. Im papa, Roger Lukaku, na Ogbonge futbola wey pley for Zaire. E get broda wey im nem na Jordan, wey don pley for Anderlecht youth tu.

Dem uze Lukaku tori du one television sho wey bi De school Van Lukaku (Lukaku School). Wen pipu wey du di television sho go meet am e tok sey, wetin fit mek am kry wel na wen e rimiba sey e don tay wey e don lik to pley for chealsea. Lukaku fit spik im Langwuej an som oda langwuej tu lik Dutch, French, English, Portuguese, Italian, Swahili an Congolese Swahili. Pesin wey dey pley bol wey Lukaku lik pas na Didier Drogba.

Lukaku na Catholic, an e dey holways prey bifor an afta match. E go Lourdes in 2014. Lukaku no dey drink alcohol.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Romelu Lukaku bbc Sport. retrived 21 June 2023