Robert O. Peters

From Wikipedia

Robert Peters wey pipu sabi as Robert's O.Peters na Naija fim produsa, direktor cinematographer, aktor, and sometimes voice-over artist. Pipu sabi am well well bikos of voice-over artist. Pipu sabi am well well bikos of di fim wey i direct for 2014 wey i nem bi 30 Days in Atlanta, and odas like Shades of Attractions (2015), Boxing Day (2016) and A trip to Jamaica (2016) wey feature ogbonge aktos and aktress like Ayo Makun, Ramsey Nouah,Richard Mofe Damijo, Vivica Fox, Dan Davies, Lynn Whitfield, Eric Anthony Roberts,Paul Campbell, Funke Akindele, Karlie Redd, Nse Ikpe-Etim, Desmond Elliott, Rasaaq Adoti, and Chet Anekwe and odas.

How i tak stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Peters for Sabon Gari,Kaduna, Northern Naija and na i bi di second pikin of eight pikin for i family. I papa nem na Lawrence Adagba and Comfort Peters. I bi Afemai man wey kom from Ososo for Akoko Edo Lokal Government Area of Edo State. Peter stat i edukashon for St. Gregory Primary School in Kaduna. Icon go University of Jos Naija, go studi Geology and Mining.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Peter stat i karia as aktor for Naija in di 1998 movie Mama Sunday, with di rol wey i pla as Paul for di 2002 daytime siris "Everyday People" wey Tajudeen Adepetu create. For 2004 i relocate go USA, na for there i kolet digree sertifikate in Visual Storytelling hosted by New York University. Peter con get connection with Film Career Connection for Atlanta, wey dem offer am on-the-job training on differen fim sets across di US. Dem still list i nem with REDucation for where some professionals dey train current and future working professionals pipu how to use Red camera and equipment. Peter stat to dey work as a cinematographer and fim editor for 2006 and i work on some African - American Productions. Inside 10 years, I work with plenty ogbonge Hollywood and Nollywood fim meka like Vivica A. Fox, Lynn Witfield, Eric Roberts,Karlie Redd, Paul Cambell, Richard Mofe-Damijo, Neville Sajere, Ayo Makun, Ramsey Nuoah, Desmond Elliott, Majid Michel, Jim Iyke, Chris Attoh, Funke Akindele, Oc Ukeje, Jeta Amata, Van Vicker, Nse Ikpe Etim, Lisa Raye McCoy, Mercy Johnson, Stella Damasus, James Michael Costello, Sulehk Sunman, Yvonne Okoro, Carl Anthony Payne, Joseph Benjamin and Tangi Miller.For 2014, News carry am sey 30 Days in Atlanta wey Peters direkt na i bi di highest selling fim for Naija box office, di fim enta Guinness Book of Record as one of di fim wey sell pass for Bollywood, Nollywood and Hollywood,oda fim wey get that kin record na PK (from Bollywood) and Star Wars: The Force Awakens (from Hollywood).

Persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Peters marri Deborah Peters and dem bon Zachary Lawrence Onafa-Orafa Peters. Na dem get Whitestone Pictures LLC, wey bi fim produkshon studio and equipment provida wey dey Lawrenceville, Georgia.