Rahama Sadau

From Wikipedia

Rahama Sadau (bon 7 December 1997) shi bi Naija aktress, bizness wuman,fim meka, dancer and singa. Shi bi popula aktress inside Kannywood and Nollywood fim industri, dem bon ha for Kaduna and shi gro op for Kaduna, shi bin don dey go dancing competition from smol and wen shi dey Skool. For 2013 Shi bikom popula inside Kannywood with ha fest fim wey I nem na Gani ga Wane. Rahama du plenti fim with Hausa and inglish and shi bi onee of di few pipu wey fit speak Hindi wel wel. Na shi wein Best Aktress (Kannywood) for di City People Entertainment Awod for 2014 and 2015. Shi kon still wein Best African Actress at di 19th African Film Awards for 2015 by African Voice. For 2017 shi bikom di fest Hausa celebriti wey dem nominate for di top ten hottest wuman celebriti. Shi bi busy pesin bekos as shi dey akt fim na I shi dey dance inside music video.

how shi tek stat life and Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Rahama Ibrahim Sadau Dem bon ha for Kaduna Stat, Naija. Ha papa nem na Alhaji Ibrahim Sadau, shi gro op with ha parent and three sisters wey their nem na Zainab Sadau, Fatima Sadau, Aisha Sadau and brother Haruna Sadau.

Sadau Joined Kannywood for (2013) thru Ali Nuhu, shi pla smol smol rol inside fim before shi bikom popula for how shi tek akt inside Gani Ga Wane, Jinin Jikina with Kannywood aktor Ali Nuhu. For 3 October 2016, di Motion Picture Practitioners Association of Nigeria (MOPPAN),wey bi di dominant association for Kannywood, dem suspend ha from kannywood for appearing in a romantic music video with a Jos born singa Classiq Q.One year afta for 2017, shi writ leta to apologize to MOPPAN. For January 2018, di ban placed on ha was lifted following di intervention of di Kano State governor Dr Abdullahi Umar Ganduje.

For 2016 shi was recognized as dat years "Face of Kannywood. For October of di same year,Sadau feature for one fim series for EbonyLife TV. For 2017, shi formed a production company wey I nem na Sadau Pictures wey shi produsa ha fest fim, Rariya shi du di fim with Ali Nuhu, Sani Musa Danja, Sadiq Sani Sadiq and Fati Washa.Shi go back akting to pla di rol of a career teacher for MTV Shuga. For 2019 MTV Shuga relocate kom Naija for series 6, "Choices", and Sadau dey one of di pipu wey folo dem relocate for di new series which included Timini Egbuson, Yakubu Mohammed, Uzoamaka Aniunoh and Ruby Akabueze.

how shi tek go skool[chenj-am | chenj-am for orijin]

Sadau studi Human Resource Management for Skool of Business and Eastern medditerranean University In Northern Cyprus