Rabbits and hares in art

From Wikipedia
Rabbits and hares in art
artistic theme
DepictsLeporidae Chenj-am

Rabbit and hare (Leporidae) na kommon tin for arts, wit difren meaning for arts an Kolsho. Dem don join di rabbit an hare wit moon gods an e stil mean pesin wey dem bon sekond taim or pesin wey kpai kon wake up. Dem stil fit mean gud tin wey dey komot beta tins.

Judaism[chenj-am | chenj-am for orijin]

In Judaism, dey kount rabbit as animal wey no kleen, bikos e dey holways chop sumtin, an im leg dey togeda no hole. Dis one don mek pipu tok bad tins abaut Christian art of di midu Ages, an kon mek di rabbit meaning long an hard. Di "Shafan" in Hebrew get one kain meaning. Bible no tu tok abaut rabbit, dem uze beta tins kompare som animal lik eagle an lion. 16th Century German pesin wey stodi abaut kolsho Rabbi Yosef Hayim Yerushalim, ci rabbit as sumtin wey stan for pipu wey no dey dia kontri but dey for difren plez for di wod.

Speshial oldin days[chenj-am | chenj-am for orijin]

For oldin days, di hare, bikos of hau important e dey , dem tok sey if e wan stil dey na for pipu to go dey kip am for hauz. Herodotus, Aristotle, Pliny an Claudius Aelianus hol tok sey rabbit na animal wey fit bon pikin pas. Na im kon mek pipu dey ci am as beta tin wey stan for wetin fit mek pesin get pikin. Di hare sarf as gift for lovers. For late olden days dem ci am as sumtin wey stan for gud luck an dey konet am wit olden days burial tradishon.

Christian arts[chenj-am | chenj-am for orijin]

For earli Christian art, hare sho for hau pesin bodi fit dey kul an oil lamps but di meaning no dey holways klear. Di physiologus, wia midu age artist dey du risarch, tok sey wen dem dey for danger di rabbit go klimb up bikos of e wan safe imsef, but wen e dey run bak down, bikos of im short front legs, pipu wey lik kpai dem dey holways co dem kil. Akording to St Basil tichin, men shud go to rock of Christ if dem wan safe, no bi to run go wod plez wey fit push dem to devil hand. Di bad way dem dey ci rabbit as animal wey no kleen, akordin to wetin dem ci for old testament, na wetin Midu age artist dey holways rememba. E kon meen sey di rabbit fit get bad meaning bikos som pipu co am as wetin dey mek man an wuman no dey get beta sex an stil fit bi gud meaning bikos e stan for gud way to bi saf fom Di wod. Weda hare meen sey pesin go fall or pesin wan safe dipend ontop hau pesin tek ondastand am.

Di Hasenfenster (hare Windows) wey dey Paderborn Cathedral an in di Muotathal Monastery for Switzerland, wey three hares image wit onli three ears for dia midu, wey mek triangle, dem ci as sign for Trinity, an go bak to old sign for time. Dem get six ears, di three hares wey sho insaid Albrecht Dürer's woodcut, The Holy Family with Three Hares (1497), dem fit stil ci am as symbol of Trinity.