Queen Oronsen

From Wikipedia

Queen Oronsen na goddess wey bi Orisha for di bilif of Yoruba pipu dem. Im na di waif of Olowo Rerengejen. Di Igogo Festival wey dem dey du evri year for Owo na to honor Queen Oronsen.

Tori wey dey Owo rekod[chenj-am | chenj-am for orijin]

For som 600 years wey don pas, king Renengejen of Owo see one fain gel wey e nem na Oronsen for di taim wey im dey one of im hontin wok. Bikos of sey Oronsen fain well wel, King Renengejen kari am go Palas an mek am queen as one of e waif-dem. Afta dia marej, Orensen sho e hosband di kain pesin wey im bi: insted mek Queen Oronsen bi nomal pesin, Orensen infakt na Orisha. Dem tok bad tin konsan di king. An as e dey du evritin wit di queen, di king supos don dai. Oronsen tel am mek e no fiar am an sey e dey hapi to dey wit am an e go dey hapi to rimen for dis laif as one of e waif-dem.Di onli tin na mek e no spoil di 3 law wey im get. King Rerengejen promis sey e go folo di three law an sey e go mek di two sinior waif to folo di law.Di king an im wait laik demsef wel wel ivin afta e don no di kain pesin wey e waif bi.Orensen kom bless di hosband an al di pipu for di haos wit plenti moni. One dey, wen King Rerengejen de insaid bush dey kash anima, Orensen get smol fait wit oda waifs dem, an dem brek im tri (3) law dem jost to mek am vex. As Oronsen bigin krai as e dey vex, e ron komot for palas. Di Shif an palas sikoriti dem bigin dey luk for am to fit kari am bak to palas bot all dia wahala to tek see am no wok. Wen di king kom bak fom insaid bush wia e go kash anima, dem tel am wetin hapun wen im no dey haous. Di tin pen am sotey e sef stat to fain am bai imsef. Afta 4 deys an 4 nait wey e don dey luk for am,e kom fainali see am for insaid fores.King Rerengejen beg Oronsen sey mek e folo am go bak, bot Orensen tel am sey as dem don brek im law e no go eva liv insaid dis laif wit pipul agein. Oronsen kom tel am mek e de du one serimoni to tek dey rimemba am,so dat e go bless Owo land an e go dey protet am evritaim . Di king no dey hapi bot e gri to du am.An afta e gif law sey mek dem kriet di serimoni afta di king go bak to di palas. Dis na di risin wai di Owo pipu dey selibret Igogo festiva sins dat dey rish todey.

Wia dem si di pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]