Quavo

From Wikipedia

Quavious Keyate Marshall (bon April 2, 1991), wey pipul sabi wel wel as Quavo, na Amerika singa, song raita, an rekod Produsa. Im dey Insaid pipul wey stat di song grup Migos. Quavo na Takeoff an Offset famili, all of dem dey insaid di Migos grup.

Quavo don folo artist wey dia song don dey top ten Billboard Hot 100 sing songs, wit artist lik DJ Khalid "I'm the one an "No Brainer", Post Malone Congratulations. Insaid 2018 e rilis album wey bi Quavo Huncho wey dey nomba 2 fo Billboard 200.

Hau e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Quavious Keyate Marshall on April 2, 1991, fo Atens, Georgia. Three memba for Migos grup gro up togeda wit am for Gwinnett County, wey dey Atlanta, Georgia.

Na Berkmar High School e go and e pley for di football team. Quavo get gud rekod for di skol team, wen e pley di skol team dey 1-9 for 2009 season. Quavo no finish skol for Berker.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Quavo, Takeoff an Offset stat Migos insaid year 2008. All di three pipul wey stat di grup bi famili an na Quavo mama ples dem live. Pipul fest sabi di grup nem as Polo club wey kom fom Lawrenceville, Georgia. On August 25 2011, di grup rilis dia fest wok wey dem kol am Juug Season. Dem du anoda wok wey dem kol am No Label, fo June 1, 2012. Plenti pipul kon sabi di group wok wel wel wen dey du "Versace" song insaid 2013. Quavo fest onli song bi "Champions" wey get difren oda artist insaid, di song rich 71 fo Billboard Hot 100.

Afta Migos sekond album wet bi "Culture" sel Wel wel, wey mek am dey nomba one for US Billboard 200, plenti artist kon dey kol am for dia songs, som of di songs na "Congratulations", "I'm the one", "Portland" an "No Brainer".

Insaid April 2017, Quavo folo for The fate of di Furious: Di album wey dey di song "Go Off". Na December 14, 2017 e rilis "Ice Tray" wit Lil Yachty. Di song dey nomba 74 for Billboard Hot 100.

Na December 21, 2017, Quavo anous say im go rilis Huncho Jack, Jack Huncho wit Travis Scott on December 22, 2017. Di album get 8 songs wey dey for Billboard Hot 100.

On January 26, 2018, Migos rilis Culture II , Quavo rilis three songs insaid im album, "Working me", "Lamp talk" an "Bubble Gum", "Working Me" rich nomba 52 for Billboard Hot 100.

For May 18, 2019, Quavo do sho wit Madonna for di final of di Eurovision Song Contest 2019.

Im pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

On April 18, 2015, polis stop Migos sho bikos dem took say all three membas for di grup get gun an dem dey yuz wetin govment don band. Dem kari am go jail kon leta rilis am wen dey leta ci say e no du am.

Quavo kolet MVP awod for di 2018 NBA All Stars game.

Quavo an Sweetie dey togeda for 2018. Sweetie kon leta tok say dey don dey togeda na for March 19, 2021 Shi tok am. Sweetie tok say dem no dey togeda bikos Quavo dey folo anoda woman.

Quavo na one of di pipul wey get FCF Glacier Boyz, wet bi team fo Fan control futbol Leaque.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Studio Album

Quavo Huncho (2018)

Album wey e du wit Odas

.Huncho Jack, Jack Huncho (wit Travis Scott as Huncho Jack) (2017)

.Only Built For Infinity Links (wit Takeoff) (2022)

Films wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Title Role
TBA Savage Salvation Coyote
Television series
Year Title Role Notes
2016 Atlanta = Quavo Steals The Show On Donald Glover's 'Atlanta' Himself Episode: "Go for Broke"
2018 Star Episode: "Dreamers"
2019 Blackish Quavo Brings His Signature Migos Adlibs to the black-ish Finale In This Sneak Peek TV Guide Episode: "Relatively Grown Man"
Ballers Episode: "Players Only"
2020 Justin Bieber: Seasons: All the Celebrity Cameos Featured on Show Episode: "The Finale"
Narcos: Mexico Episode: "Alea lacta Est"

Awods an Normination[chenj-am | chenj-am for orijin]

Caption text
Year Big textAwods Katigori Norminated Wok Result
2017 Team Choice Awod Choice Electronic/Dance song Know no better Won
2017 MTV Music Awod Bes Hip Hop Video I'm di one Norminated
2017 America Music Awod Collaboration of di year I'm di one Norminated
2018 Nickelodeon kids choice Favourite song
2020 MTV Music Video Awods Bes pop Video Intention Pending