Princess and dragon

From Wikipedia

Princess and dragon na one of di standard way of tellin tradishonal old tori, romatik tori. Northrop Frye tok sey "Princess and dragon" na sentra part wey romans tori dey always folo. Di tori dey tok abaut one hi-klass wuman wey get save from dragon. Di dragon fit bi original dragon or Jos eni denja. Na one man wey bi hero go kom save di hi-klass wuman or princess for di tori. Di tori fit show sey na di princess bi di fest pesin wey wan faze dis kind of dragon or e fit show sey na di princess bi di last pesin wan dis tin wan hapun to. Di tori dey always finish wen di princess mari di man or hero wey helep kill di dragon Wen Aarne-Thompson wan rait tori abaut Princess and dragon' in type 300 an Dr e patan dey always bi like this: E fit remain smol make dem yuz di princess as sakrifahi wen di hero kom save am, one fake hero wen go fest kom dey tok sey na im go do am, an di main hero wey pipo go kom see sey na im do am tru-tru.

Histri of di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

One of di tori of Princess and dragon wey don old pass na di one wey kom from olden days Greek tori of Perseus. Perseus save di princess Andromeda mek Cetus no chop am. Cetus na one big hanima wey de inside wota wey no risembu snake or dragon.

Other tradishonal old tori of Greek folo di dem patan of Princess and dragon like di Heracles. For di tori of Heracles, e save princess Hesione of Troy mek one big hanima no chop am.

In dos tori, most of dem dey tok sey di dragon kom bikos dia gods dey vex for di pipo. For ezampul, in Andromeda tori, di dragon wan kill di princess bikos di princess mama Queen Cassiopeia kompiya Andromeda beauti to one fimeli god wey de live inside wota. For di tori of Hesione, di dragon wan kill am bikos e papa no wan agree on wetin im an Poseidon don gree bifor. 'Princess and dragon na one of di standard way of tellin tradishonal old tori, romatik tori. Northrop Frye tok sey "Princess and dragon" na sentra part wey romans tori dey always folo.