Jump to content

Premier League Hall of Fame

From Wikipedia

Di Premier League Hall of Fame na wetin dem dey giv playas an managers wey don pley wel wel for premier League, wey bi di top for English football League system. Dem stat am for 2020 but for 2020 dem no du am bikos of COVID-19 pandemic, Di Hall of Fame na to dey uze am dey sabi an honor playas wey don du beta tin for di League sins web dem stat am for 1992.

As pat of di one wey dem du for klas 2021, eight playas dey insaid; Alan Shearer, Thierry Henry, Eric Cantona, Roy Keane, Frank Lampard, Dennis Bergkamp, Steven Gerrard, and David Beckham. Di year wey folo anoda eight playas dey insaid, and in 2023, Alex Ferguson an Asène Wenger bi di fest manager wey go dey insaid am.

Hau dem tek dey selet pesin

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor dem selet playas for di Hall of Fame, dem get wetin dem go chek, di nomba one tin na for di playa to sho sey im sabi im wok wel for field an don sopot di League to gro sins dem stat am for 1992. Som oda tins wey dem dey chek na, di playa go don stop to dey pley bol bifor Di season wey dem go stat dey giv Di awod, an na onli bol wey dem pley for di League dem go uze jorj dem. Anoda tin bi sey di playa go don sho for di League 250 times, abi mek e get one of dia:

 E go don sho pas 200 times for one of di 
 Premier League join.

 Dem don selet am as one of di Team of the 
 Decade or 20 years Anniversary teams
 Don win Premier League Golden Booth or Golden 
 Gloves.
 
 Don vote am as Premier League playa of di 
 season bifor.
 Don win three premier League title
 Don skore 100 premier League goals, or
 goalkeeper wey don dey post an dem no score am

 rich 100 goals bifor anoda one enta.
Wen dem anous di Hall of Fame in 2020, Premier League chief executive Richard Masters tok sey chans dey for pipul wey du wel for di League.

Pipul wey dia nem dey insaid

[chenj-am | chenj-am for orijin]
Playas wey dey insaid for 2021
YearPlayasAppsGoalsPositionYearsClubsWetin e don get
2001Alan Shearer441260FW1992-2006Blackburn Rovers Newcastle1x Champions,3x Golden Booth, 1x playa of di season,
2021Thierry Henry258175FW1999-2007, 2012Arsenal2×Champions, 4×Golden Booth, 2× playa of di season,
2021Eric Cantona15670FW1992-1997Leeds United Manchester United4× Champion
2021Roy Keane36639MF1992-2005Nottingham Forest Manchester United7× Champion
2021Frank Lampard609177MF1995-2015West Ham United Chelsea Manchester City3× Champion 1× Player of di season
2021David Bergkamp31587FW1995-2006Arsenal3× Champion
2021David Beckham26562MF1995-2003Manchester United6× Champions
2021Steven Gerrard504120MF1998-2015Liverpoolselected overall team of di decade
Playas wey dey insaid for 2022
YearPlayasAppsGoalsPositionYearClubsWetin e don get
2022Wayne Rooney491208FW2002-2018Everton Manchester United5× Champion 1× players of di season
2022Patrick Viera30732MF1996-2005, 2009-2011Arsenal Manchester City3× Champion 1×Player of the season
2022Paul Scholes499107MF1994-2011, 2012-2013Manchester United11× Champion
2022Sergio Aguerio275184FW2011-2021Manchester City5× champion 1× Golden booth
2022Didier Drogba254104FW2004-2012, 2014-2015Chelsea4× Champions, 2× Golden Booth
2022Vincent Kompany265184DF2008-2019Manchester City4× Champions 1× player of the season
2022Ian Wright213113FW1992-1999Arsenal West Ham United1× Champion
Caption text
YearPlayasAppsGoalsPositionYearClubsWetin e don get
2023Tony Adams25512DF1992-2002Arsenal2× Champions
2023Peter Czech4430GK2004-2019Chelsea Arsenal4× Champion
2023Rio Ferdinand50411DF1995-2015West Ham United Leeds United Manchester United QPR6× Champion
Managers wey dey insaid
YearManagerGamesWinsWins%YearsClubWetin e don get
2023Alex Ferguson81052865%1992-2003Manchester United13× Champion, 27× Manager of the month, 11× Manager of the season.
2023Arsene Wenger82847657%1996-2008Arsenal3× champion, 15× Manager of the month, 3× Manager of the season

Playas wey don win am kontri

[chenj-am | chenj-am for orijin]

As of May 2023 Awod

Caption text
KontriPlayas
England9
France3
Argentina1
Belgium1
Czech Republic1
Denmark1
Ireland1
Ivory Coast1
Netherlands1

Managers wey don win kontris

[chenj-am | chenj-am for orijin]

As of May 2023 Awod

Managers an kontri
KontriManagers
France1
Scotland1