Polo Park

From Wikipedia

Polo Park (corporately styled as CF Polo Park) na shopping centre for Winnipeg manitoba Canada. Di polo park dey for di former polo park Racetrack near di junction for portage Avenue and St James street. Polo park ground also include scotiabank theatre (formerly Silver city).

Na di largest Mall for di 8 malls for di city and di 15th largest Shopping centre for Canada ranking between Guildford Town centre and laurier Quebec. For census purposes Polo park na also di name wey dem give di neighborhood including di surrounding for di shopping centre.

How polo park take start[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di polo park Mall start for Thursday 20, August 1959 and become one of di first enclosed shopping malls for Canada wey dem add roof for 1963, di oder wey be di park Royal Shopping hubs of Winnipeg with di Winnipeg Arena, Canad Inns stadium and Winnipeg velodrome all of dem dey for polo park neighborhood. For 1990s di velodrome dem stop to use am come make way for strip mall wey include Home Deport and chapters. Fot long time di Arena and stadium dem break am down and replace am with new retail and office complexes.

Di former CKY building be di next for di mall. CKY house di city television Network affiliate, CKY-TV, CKY-Radio and FM 92 CITI before CKY be di original house for WTN network. Corus Entertainment and Cadillac Fairview. Studios for CJOB 680, CFPG-FM99.1 and CJKR-FM 97.5 dey for di second floor for di three story building.

How Polo park start to dey expand[chenj-am | chenj-am for orijin]

For spring of 1968 dem use $7.5million to take complete di expansion of polo park. Dis addition bring three storey Eaton's department store to di mall wey make polo park di second largest shopping centre for Canada for that time.

For 1986 di mall go tru renovation wey cost $75 million wey give di building second level. Di downtown Winnipeg merchant no dey happy with di plan so dem carry di matter go city council go talk dia mind after di meeting for 1984 council still approve di expansion of di building even as dem no gree. Di expanded shopping centre open for mid- August 1986.

A new $49 million expansion to polo park open for 1 October 2014 for di former Zellers space for di mall second level. Di redeveloped space include 114000 sq ft(10600m) of retail space and e create 17 new stores.

Areas Wey Polo Park Cover[chenj-am | chenj-am for orijin]

Polo park don add new retail complexes wey di location of di properties dey adjacent to di north of di mall.

Pilo North dey for di site of di former Winnipeg Arena and e get Marshalls, marks, Atmosphere and di new head office of western financial.

Di plaza wey dey polo park for canad inns stadium ground adjacent to scotiabank Theatre na mixed use development wey spans over 600000 sq ft (5600m) wey carry di following Winners, Homesense Urban Behavior, Winnipeg metropolitan Region inc and di first P.F chang's restaurant for Winnipeg with parking capacity wey fit carry over 1200 vehicles, dem build di plaza originally to house Target Canada wey come later go out of businesses tru out Canada.