Phyllis and Aristotle

From Wikipedia
Woodcut Phyllis sit-down ontop Aristotle

Di tori of Phyllis an Aristotle na one tradishonal old tori wey pipo dey tok to fit advais man to dey kia-ful abaut wuman. Phyllis wey bi wuman yuz e fine faze an bodi tek kontro Aristoles to do wetin e want. Aristoles na one Greek filosofi man wey get sense wel wel. Phyllis an Aristotle tori na one of di popula tori wey show how wuman get pawa rish to fit kontro man. One of di tori vashon wey don tey na di 1220 French vashon Lai d'Aristote

Meni artists rili tok an rait abaut dis tori of dis wuman wey yuz sex kontro di man wey pipo sabi wel wel as pesin wey get sense pass from di 12 senturi . Dey draw di tori for stone wey dem yuz do chorch wall, dem draw am for kapet, dem draw am for glass an meni odas tins. Artist wey do somtin abaut Phyllis an Aristotle tori na Hans Baldung, Albrecht Dürer, Lucas Cranach the Elder, an Alessandro Turchi.

Wetin hapun for di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Difren difren vashon of di tori de. But di koko of di tori na im bi dis: Aristotle advais Alexander mek e no dey folo Phyllis do tins. Phyllis na asewo ( prostitute) to Alexander papa wey bi di king. Di koko of di mata bi sey Aristotle wey dey give advais sef get eye to slip with Phyllis. Phyllis, wey bi asewo to di king kom gree sey e go slip with Aristotle on one kondishon onli: Aristotle go do like donki an e go sit ontop of am as e go dey tel am eni wie to move as both of dem de inside bedroom. Phyllis don tel Alexander sey mek e hide for one side as e go yuz e own see di pawa wey wuman get to kontro man. Som vashon tok sey Phyllis na Alexander asewo or e fit bi e wife sef.