Pete Edochie

From Wikipedia
Pete-edochie

Shif Pete Edochie, MON (dem bon am for March 7, 1947) na Naijá aktor. Edochie na one of Afrika most talented akto, an im don get plenti plenti awod laik Industry Merit Award by Africa Magic an Lifetime Achievement by Africa Film Academy. Edochie bifor na administrator an brodkasta but, na for 1980 wen NTA redu Chinua Achebe buk Things Fall Apart as fim, Edochie akt as Okonkwo for di fim na im mek pipu no Pete Edochie wel wel. Edochie kom fom Igbo traib of Naijá an na katolik e bi For 2003, President Olusegun Obasanjo gif am nashunal honor wey bi "Member of di Order of the Niger" ==Pasonal laif== Dem bon Pete Edochie for siti of Zaria wey dey norti of Naijá for March 7, 1947.Edochie selebret e 70 years biday for 2017 an e tok sey e stil dey strong.Edochie stil tok sey na to dey tek laif easi an dey plan wit purpos for evritin na im mek laif no taiya am as im dey old.

=How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Edochie stat tok tok wok for redio wen e bi 20 years old. Na Programme Assistant dem gif am wen e stat.Edochie kom gro to levu of Dareto.E bi dareto of programmes, bot e dey akt as Managing Dareto.Edochie stop to wok for ABS bikos di govament stat to du politis for dia FM station mata an dis one kom mek dem poshu all di pipu wey dey manej di station wit Edochie join. Na Edochie for replas di MD bot e komot komot go join muvee indostrie. Bifo dis one, Edochie don akt foy di fim, Things Fall Apart, an win International Award. BBC flai kom Naijá to tok to Edochie abaut e rol for Things Fall Apart. Edochie don akt over 18 fim. For September 2017, Edochie sopot Wikimedia Movement for Naijá wen e sho faze for vidio wey dem mek to hep pipu wey don old no how to yuz Wikipedia.

8 big nem for Naijá fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2005, The Actors' Guild of Nigeria gif Pete Edochie, Genevieve Nnaji, Omotola Jalade Ekeinde, Nkem Owoh, Ramsey Noah, Stella Damasus Aboderin, an Richard Mofe Damijo one-year ban fom aktin eni fim bikos of di plenti plenti moni we dem dey kolet fom produsa to dey I said fim. Dis ban sheik Naijá fim bizness wel wel, bot dem don komot di ban.

Dem Kidnap Edochie

For 2009, dey kidnap Edochie bot dey leta liv am wit out injuri.

Peson wey risembu Edochie

For 2019, pipu tok sey Kingsley Abasili risembu Pete Edochie wel wel even pipu wey dey mek niuz kari am. Bikos Kingsley luk laik Edochie, dem kom kol Kingsley Pete Edochie's look-alaik.

Im pat for Fatal Arrogance For 2020, Pete Edochie akt a lid rol for di muvee wey di taitu bi "Fatal Arrogance". Dis fim kos trobul wit Islamic Movement in Nigeria (IMN) wey pipu still no as Shiites. Di pat wey Pete Edochie akt wan sho sey dia grup get leg for terrorist grup. Di akto no gri sey na im get blem for di trobul di fim kos bot sey na di pipu we produs di fim dem sopos blem for di trobul wey di fim kos.

Fim-dem wey e akt insaid[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Heavy Battle (2008)
  • Test Your Heart (2008)
  • Greatest Harvest (2007)
  • Secret Pain (2007)
  • Fair Game (2006)
  • Holy Cross (2006)
  • Lacrima (2006)
  • Living with Death (2006) .... Mr. Harrison
  • Passage of Kings (2006)
  • Simple Baby (2006)
  • Zoza (2006)
  • Azima (2005)
  • Baby Girl (2005)
  • End of Money (2005)
  • Living in Tears (2005)
  • Never End (2005)
  • No More War (2005)
  • Ola... the Morning Sun (2005)
  • Price of Ignorance (2005)
  • The Price of Love: Life Is Beautiful (2005)
  • Sacred Tradition (2005)
  • The Tyrant (2005)
  • Across the Niger (2004)
  • Coronation (2004)
  • Dogs Meeting (2004) .... Anacho
  • Dons in Abuja (2004)
  • The Heart of Man (2004)
  • King of the Jungle (2004)
  • Love from Above (2004)
  • My Desire (2004)
  • Negative Influence (2004)
  • The Staff of Odo (2004)
  • St. Michael (2004)
  • Above Death: In God We Trust (2003)
  • Arrows (2003)
  • Billionaire Club (2003)
  • Egg of Life (2003)
  • Honey (2003)
  • Love & Politics (2003)
  • Miserable Wealth (2003)
  • The Omega (2003)
  • Onunaeyi: Seeds of Bondage (2003)
  • Rejected Son (2003)
  • Selfish Desire (2003)
  • Super Love (2003)
  • Tears in the Sun (2003)
  • Tunnel of Love (2003)
  • When God Says Yes (2003)
  • Battle Line (2002)
  • My Love (2002)
  • Tears & Sorrows (2002)
  • Greedy Genius (2001)
  • Holy Ghost Fire (2001)
  • Terrible Sin (2001)
  • Oduduwa (2000)
  • Set-Up (2000)
  • Chain Reaction (1999)
  • Lost Kingdom (1999)
  • Narrow Escape (1999)
  • Living in Darkness (1999)
  • Rituals (1997)
  • Things Fall Apart (1987), TV series
  • Last Ofalla
  • Lion throne
  • Lion of Africa
  • Igodo
  • Evil men
  • Monkey chop banana
  • Idemili
  • 50 days with Christ
  • The Egg
  • Unroyal (2020)
  • Lionheart (2018)
  • Mummy Why (2016)