Jump to content

Patricia Shehan Campbell

From Wikipedia

Patricia Shehan Campbell na Amerika pesin wey dey stodi how difren difren kolsho dey mek muzik an how di muzik dey du pipul way dey lisin to am.

How e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Campbell bi di Donald. E Peterson Professor at di Yunivasiti of Washington. For di Yunivasiti, e dey tish muzik edukeshon an Ethnomusicology. Bogor Campbell bi professor, e na memba of di falkoti of Washington Yunivasiti in St. Louis an Butler Yunivasiti. Part of Campbell trainin bi playful dans muzik, piano an vois paformans, Campbell trainin stil bi stodi of Bulgarian group song, Indian (Karnatic) vokal koleshon an di Thai mahori. Dey add Indian vokal koleshon an di Thai mohori wen e stil de du e Ph.D stodis in Muzik Edukeshon ( Di stodis konet wit ethnomisicolohy) for Kent State Yunivasiti. Di fest ples wey e fest stodis na Cleveland Muzik Skul Setumet an na dia e Len how to play Piano. Na Jonas Svedas an di pesin wey dey kompose am Bain Murray dey tish am den. Campbell don fest tish group vois muzik in Cleveland aria skul bifor e kom chuz to bi a muzil tisha. Campbell don hep arenj wetin pipul wey dey go skul go dey du in St. Loius, Indianapolis, an Settle aria. E don yuz di free edukeshon wey "National Endowment for the Humanities, the National Endowment for the Arts, the International Research Exchange (IREX), Fulbright-Hays, the Lily Endowment, and the International Foundation for Music Research tek get beta trainin an no more tins abaut Muzik Edukeshon. Campbell hasist meni profeshonal hoganiaashon ( for ezampul, di Sosaheti for Ethnomusicology, di Intanashonal Sosaheti for Muzik, an di Kolej Muzik Sosaheti). Campbell don bi presidor of the Kolej Muzik Sosaheti, e don wok as Vais Presidor of di Sosaheti for Ethnomusicology, an di Oga patapata for di Board of Smithsonian Folkways. E don wok as editorial boards of di Sakoloji of Muzik, British Jonal of Muzik Edukeshon, Risach Stodies in Muzik Edukeshon, Jonal of Risach in Muzik Edukeshon, Kolej Muzik siposiom, an odas jonal. Campbell stil join hand as editor of di Global Muzik Series of Oxford Yunivasiti Press