Patricia Lysaght

From Wikipedia
Patricia Lysaght
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Fest nemPatricia Chenj-am
Famili nemLysaght Chenj-am
Wen dem bon am6 March 1948 Chenj-am
Wok wey e dey dufood writer, raita, profeso, folklorist Chenj-am
Post wey e deyPresident of The Folklore Society Chenj-am

Patricia Lysaght ( dey bon am in 1948]] na Ireland wuman wey dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Lysaght na Professor Emerita of European Ethnology, Yunivasiti Kolej, Dublin in Ireland.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for County Flare dey bon Patricia Lysaght. Lysaght fest dey rid law bifor e kom chenj to ridin Ireland Langwej an Litirashun, an European Folklore an Ethnology. Lysaght finish e Ph.D at di Nashonal Yunivasiti of Ireland in 1982.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lysaght poblish one buk in 1985 wit di nem The banshee: a study in belief and legends about the Irish supernatural death-messenger. E poblish di buk base on e Ph.D Pepa wey e rait. One pesin wey check di buk tok sey na beta buk for Ireland tradishonal tori an intanashonal tradishonal tori stodis. For di time wey Lysaght don wok, e don rait ten buks an rait ova one hundered hatikuls. Di risach wok wey Lysaght dey rait na abaut tradishonal majik tori of Ireland an on Ireland food an how Ireland pipuk dey produs dem. Na Lysaght bi di presidor of di International for Ethnology Folklore's Working Group on Food Research. Lysaght don wok as Editor of both Folklore ( Jonal of di Folklores Sosaheti, London) an Béaloideas (Jonal of di Folklore of Ireland Sosaheti, Dublin).

Awod-dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Lysaght don get meni skolaship an visitin professor at a nomba of intanashonal Yunivasiti an Institute like Westfälishe Wilhelms-Universität, Münster, an di Russian Akademi of Sayens, wey de Moscow.

Dey chuz Lysaght as memba of di Royal Irish Akademi in 2006. E stil bi memba of di Royal Gustavus Adolphus Aka demi for Swedish Folk Kolsho. Di Akademi give am di Torsten Janckes minnesfond prize awod for di way e tek wok in Folkloristic an Ethnological Scholarship in to 2013. Lysaght stil kolet di Coote Lake Medal of the Folklore Society for di beta wok wey e du in risach an skolaship.