Parable

From Wikipedia

Parable na one short tori wey fit tish pesin lesin or prinsipul. "Parable" dey difren from dos tori wey pipo dey yuz hanima, plant, or odas tin esplen. For "Parable", na human bein tori dey de inside am. For parable tori, we dey yuz one karata tek kompiya anoda karata wey we wan tok abaut. Some pipo wey don stodi an sabi di four gospel an di niu testament for bible dey yuz parable for onli di tori wey Jesus tok. Di koko bi sey parable tori still dey wey no bi di one wey Jesus tok for bible. For of di parable wey Jesus yuz to helep tish na "Parable of di prodigal son".

Orijin of di word[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di word "parable" kom from one Greek word παραβολή wey mins to dey kompiya, or to esplen.

Histrie of parable[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bible get plenty ezampul of parable wey de di Gospel an di Niu testament (Jesus Parable). Some pipo wey sabi buk (like John P. Meier) tok sey parable kom from mashalim. Mashalim na one Hebrew tori wey dey popula dorin di Talmudic period. (c. 2nd-6th senturi C.E).

Ezampul of parable wey Jesus tok na Good Samaritan, an di Prodigal Son. Mashalim wey kom from old testamet na di one wey Nathan tel David abaut lamb ( 2Samuel 12:1-9). Anoda Mashalim wey dey di old testamet na di parable of one wuman wey kom from Tekoah (2Samuel 14:1-13).

Parable also dey inside Islam. For Sufi tradishon, na parable dem dey yuz tish lesin an tish beta karata. Niu niu raita of buk like Idries Shah an Anthony de Mello don work wel wel so dat pipo wey no sabi Sufi tradishon go fit sabi dos parable. Niu niu parable don dey now, E get one 19 senturi parable wey bi Parable of the broken window wey no sopot one part of ekonomik tinkin.