Oyin Adejobi

From Wikipedia

Chief Oyin Adejobi (1926-2000) na Naija actor wey get sense as persin wey dey do fim and dey write fim way people go do for stage.Adejobi dey popula for Ekiti, Ondo, Ogun, Osun, Oyo and Lagos wey be di state for Nigeria. Adejobi rite and do many fim for yoruba pipu wey pipu look for Televishon, for cassette and for stage. Sins e na chief, pipu dey call am by tdi chief name Grace Oyin Adéjọbí. Di tru matter be sey Grace to dey di nem wey e papa give am wen dey born am. Pipu no am well well for di fim wey e do wey talk about e life story. Di fim nem na Orogun Adedigba. For dat time wen e never die,e get one show wen dem Dey show for everi week for Televishon and di show na Kootu Asipa (Ashipa Court), for Naija Televishon Authority, for Ibadan.Dey even nem one company wey dey do play for stage with Adejobi name. Di company na The Oyin Adejobi Theatre Company.

Fim wey e don do or act inside[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Iya Olobi
  • Orogun Adedigba
  • Ile Iwosan
  • Kootu Asipa(Ashipa's Court)
  • Iyekan Soja
  • Ekuro Oloja
  • Kuye