Ovie Omo-Agege

From Wikipedia

Obarisi Ovie Omo-Agege CFR (dem bon am for 3 August 1963) na Naija lawya an Politishian na im bi di Deputy President of the Nigerian Senate. Na im stand for Delta State Central insaid Naija Senate. Omo Agege na fom Orogun clan wey bi Urohbo pipul wey dey Ugehlli North Lokal Govment of Delta State. Na 11 June 2019 im bi di Deputy President of the Naija Senate afta e win Ekeremadu wit 31 votes.

Na Omo- Agege bi di fest Pesin fom Delta State wey go bi Deputy President of the Nigerian Senate.

How e tek stat lif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 3 August 1963 dem bon am insaid Delta State. E go St. George Grammar School, Obinomba Obiaruku, Delta State.

Skol wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na law e go stodi for University of Benin insaid 1985. Dem kol am for insaid Nigeria Bar insaid 1986.

For 1983 e get degree for law fom Tulane University Law School.

Im Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem post Omo-Agege go Kwara stet for National Youth Service Corps (NYSC) to sarf im kontri. Im finish im National Youth Service Corps (NYSC) for Naija Police force, Kwara Stet Command. Omo Agege fest wok for Pat Okupa & Co. wey dey Lagos insaid 1987.

For 1989, e dey insaid pipul wet stat; Agege & co. Omo Agege go United States of America insaid 1990, e go wok for Charles O Agege law ofis wey dey Los Angeles, California.

Politis Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omo Agege stat politis onda People Democratic Party (PDP). Di fest time wey e won go for House of Representatives onda People Democratic Party (PDP) for Delta Stat, e no enta. Insaid 2003, bifor bifor Delta Stet Govnor, James Ibori, mek Omo Agege one of im adviser, wey e du for two years. Dem stil leta giv am anoda post wey bi Commissioner for Special Duties. E go try enta for Delta Stet Govnor but e loss for People Democratic party (PDP) primary to Govnor Emmanuel Uduaghan. Na im bi di Secretary to di Stet Govnor insaid Delta Stet, onda Govnor James Ibori for 2007. E go for Senate onda Labour Party insaid 2015. E enta as senator wey dey for Delta centra on 28 March 2015.

E komot for Labour Party kon go All Progressive Party (APC) 7 March 2017. Na im enta enta senator for Delta Stet insaid 2019 eleshion. On 11 June 2019, na im bi di niu Senate Deputy President.

Katakata wey hapun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Insaid 2018, dem tok sey e Kari som pipul go skata Senate hause.

Pasonal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omo-Agege get five pikin an im wif na Rose Mary Omo-Agege.

Awods[chenj-am | chenj-am for orijin]

President Muhammadu Buhari giv Omo-Agege Order of the Federal Republic of Nigeria(CFR), insaid October 2022.