Origin stories of the Goths

From Wikipedia

Plenti tori dey ontop hau Orijin storis of di Gothic pipu wey Dem rekod by di Latin an Greek raitas for late 3rd an 8th century AD, an plenti pipu wey dey du buks don like di tori wit pipu wey dey stodi histri sef tok sey di tori na true abaut Goths an oda pipu dem.

Di fest taim wey dey menshon Goths na fom Bible tok tok, an sey Goths na pipu wey live for around Black Sea an Lower Danube, di Gatae sef, an Scythians. Di three plez wey pipu sabi pas abaut dia tori pas na tori by Jordanes, Isidore of Seville, an Procopius.

Dey put Jordanes Getica insaid pipu ogbonge pipu for origio genetis (wia pipu kom fom) for one bike wey Herwig Wolfram rait.

Goths as Scythians, Getae an pipu wey kom fom Magog[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di Goths, an oda Gothic pipu lik di Gepids, live for north of Roman empire wey dey front of di lowa Danube for one aria wey don bi home to Gatae, Dacians, an Samaritans, an som Scythians. Pipu wey dey live as Gothic pipu get konecshon wit Goths an som pipu wey don live wit "Scythia".

Insaid fest half of third centuri, Dexipopos, wey get histri as onli pesin wey dey live for im tribe, tok abaut Goths of im taim as Scythians, but e no Tok sey hol Scythians kom fom di sem plez.

Di fest pipu wey tok abaut Goths abi Gethia an Scythians as di sem na fest Kristians wey dey len, Ambrose (abaut 340 - 397), Orosius (abaut 375 - 420) an Jerome (abaut 347 - 420). Ambrose join Goths an Scythians wit Bible tori of Gog an Magog, wey kom fom far north, wia Island dey.


Ambrose, insaid im De Fide ll.xvi tok sey d oga kpatakpata for Magog wey dey buk of Ezekiel for bible stan for di '"Goths" (hoc est Gothis), as one vision for Bible tok am, na pesin wey go kom fom north, wey go kom fom horse bak as one big army, wey dem go win am. Gog an Magog still bi island bikos God go send fire wey go mek am no dey big island again.

Arne S. Christensen, na one pesin wey dey len abaut di bible tu. Akordin to am e tok sey one pesin wey no lik wetin Ambrose tok abaut hau e tek join Goths an Bible Magog an Gog togeda na Josephus (wey kpai in 100), wey dem add Scythians wit di biblical Magog, wey e sabi as pesin an no bi kontri. Dis one na ontop one tori wey dey Buk of Genesis. Na konecshon wey dey for Genesis Magog, an di Gog fom Ezikiel, wey bi oga kpatakpata for kontri wey bi Magog, or Gog an Magog fom di 1st Century AD Buk of Revelation vision. Na im mek oda raitas konet Goths, as Scythians.