Omowunmi Akinnifesi

From Wikipedia

Omowunmi Akinnifesi (Dem bon am December 4, 1987) na Naijá bizness wuman and environmental ambasedor for Legos.

How Shi Tek Stat Life An Go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi bi di dotar of one foma direktor of Central Bank of Nigeria, na for Legos Stet dem bon am but shi stey for Sierra Leone wen shi dey smol bifor shi kom bak kom join im famili for Naijá. Shi go Queen's College Yaba, wey shi win plenti prize for her artwork. For 2008, Akinnifesi finish from di University of Lagos wit digri for Geography and Regional Planning. For 2012, Akinnifesi get masta digri in Environmental monitoring, modelling an management from Kings College London.

How Im Tek Stat Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2005, eighteen year old Akinnifesi win di Most Beautiful Gel for Naija, dis one kom make Naijá pipul-dem chuz ham as di pesin wey go reprisent Naijá for di Miss World Pageant for China dat sem year where shi plant tris for di Chinese guvment. Akinnifesi kari sekond for di Naijá varshon of strictly come dancing, celebrity take 2. Afta dis one, shi kom stat her own public relations an ushering bizness wey shi kol Elle Poise. Dey no Akinnifesi as pesin wey Sabi style an dey honor am for di 2011 Allure Style Awards. Na for dis time shi kom opun-up sey for six years shi notice sey somebodi dey follo-follo am an dey put eye for her bodi dey way shi no like wey mek ha dey fear. For 2016, Akinnifesi stat her own klothing line wey shi kol "Omowunmi"