Olu Oyenakpagha

From Wikipedia

Olu Oyenakpagha wey pipu stil sabi as Olu Obanighenren bi di nomba 8 Olu wey bi king for Warri Kindom wey de rul Itsekiri pipul in Naijá. Dem giv am di nem Omonighenren wey di mini na Prince wey get bodi wey bi laik gold. As e sit for di tron laik Ogiame, Olu of Warri Kingdom, dem giv am nem wey bi Obanighenren, an di nem mini na King we get bodi we bi laik gold. Anoda nem we e get na Don Antonio Domingos. Na im bi di son of Olu Atuwatse I (Olu Dom Domingos) an afta im papa don dai e kom bi di nomba 8th Olu of Warri. E rait one leta giv Pope Clement X for 1652 wey dem kari giv am. Na for hause e go skul an kom go one big skul for Angola. Laik im papa, na Portuguese wuman e mari.E son Olu Omoluyiri kom bi king afta am.

Where Dem Si Pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]